Jose Mourinho: Tottenham appoint di special one to replace Mauricio Pochettino as manager

Jose Mourinho

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Jose Mourinho go replace Mauricio Pochettino wey di club sack on Tuesday
Published

Tottenham Hotspur don appoint Jose Mourinho as dia new manager to replace Mauricio Pochettino.

For inside statement wey di club release dem say di former Manchester United and Chelsea boss sign contract wey go see am stay for di club until di 2022/23 season.

Spurs sack Pochettino, wey be 47, on Tuesday afta im spend five years in charge of di north London club.

Tori be say Pochettino and di club chairman Daniel Levy relationship get as e be, but di decision to sack am na sake of di team poor results wey start since last February.

Mourinho neva work since wey United sack for December 2018.

Dis na wetin Levy tok about di special one : "with Jose we get one of di most successful managers for football. Im get beta experience, if fit ginger teams and im be great tactician.

Im don win trophy dem for everi club im don coach. We believe say im go bring dat same energy come our dressing room."

Di former Chelsea, Porto, Real Madrid and Inter Milan manager don reject some job opportunities, for China, Spain and Portugal, since im leave Old Trafford.