Queens college Lagos: Wetin dey make students sick for di school ?

Parents for Queens College Lagos south west Nigeria don tell BBC say true-true disease outbreak happun for di school and e affect plenti pikins.
Oga Damian say im child na victim of di disease outbreak but e don well now.
"Dem call me to come carri my pikin, as I reach di school I see plenti students wey dem clear to go home sake of di outbreak. Dem treat my pikin for malaria and infection" na so Mr Damian tok.
E say "now my pikin don dey ok to go back to school but dem no gree sake of say she neva finish her drugs".
Oda parents confam say dia pikin dem too catch sickness while some say di tori no true.
Dis wan na afta tori comot for local media on Tuesday say disease outbreak happun for di school and dem don send plenti pikin home wey dey affected.

However, goment for Lagos state say dem don begin torchlight wetin happun for di school and dem go also go oda schools to chook eye.
Dem confam say about 89 students bin go for treatment for Queens college sick bay sake of respiratory tract infection.
End of Di one wey oda users dey read well well
Our tori pesin also take eye sight some health officials from di Ministry of health wey dey di school to carry out some investigations.
Wen BBC Pidgin visit di school on Wednesday, authorities no gree make tori pipo enta inside di school and dem refuse to comment on di mata, but some students wey don recover from different sickness and wan resume school bin dey outside di gate.

Some parents wey no gree make we show dia face say dem no happy how dia children dey suffer for di school.
Some students also tell BBC say di school dey overcrowded, dia toilets and bathrooms no good and plenti stagnant water full ground wia mosquitoes dey live.
"Wen we dey bath, water wey park for ground go dey splash your body sake of say e no dey flow out well, di WC no get water inside so we dey go fetch water to flush toilet" na so one student tell our tori pesin.
Dis no be first time dis kain tin dey happun for di school. For 2017, local tori pipo Punch report say three students die from water-borne infections.















