You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Kano Governorship Tribunal: Court declare Ganduje winner of 2019 election
Election petition tribunal for Kano, north west Nigeria don rule say Govnor Abdullahi Ganduje na di winner of di March 2019 govnorship election for di state.
Justice Halima Shamaki na im give di ruling on Wednesday afternoon.
Nigeria main opposition Peoples Democratic Party - PDP candidate, Abba Yusuf bin dey challenge di victory of di ruling All Progressives Congress - APC Govnor Abdullahi Ganduje.
Di judge say PDP wey dey challenge Ganduje victory for the election tribunal no prove dia case say mago-mago happun for di inconclusive elections wey hold on 23rd March 2019.
Justice Halima say PDP get legal right to carry di mata go up to supreme court level if dem no dey satisfied and also say make supporters no fight over di ruling because Kano na her state.
Governor Ganduje supporters don begin celebrate across di state while PDP supporters don begin vex ontop di ruling on social media.
Early before dem deliver di judgement, di court room bin full dey pour for di Kano Governorship election petition tribunal wia pipo bin dey wait for Justice Halima Shamaki to deliver di ruling.
Politicians bin full evriwia, even occupy where journalists suppose sidon according to BBC Pidgin tori pesin wey dey ground.
End of Di one wey oda users dey read well well
On March 24, 2019 afta Nigeria election office - Inec- bin declare di March 9 election inconclusive come organize anoda one - di election Returning officer for Kano state Bello Shehu, wey announce di result say Ganduje, wey be di current govnor of di state, score a total of 1,033,695 votes to defeat im closest rival, opposition People's Democratic Party candidate Abba Kabir Yusuf wey get 1,024,713 votes.
But before Nigeria election office declare Ganduje winner, some of di party agents bin provoke say wuru-wuru full inside di election.
Na from there na im PDP carri di mata go tribunal.