You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Jumia say magomago happun for dia company
Online company Jumia, don confam say magomago happun for operations for Nigeria - dia biggest market.
Di company say dem don suspend dia workers wey get hand inside those transactions and say dem dey torchlight di mata.
Jumia say wuruwuru orders wey di pipo place reach 2% of wetin di company sell last year and 4% of wetin dem sell for first three months of dis year.
Oga patapata for Jumia, Sacha Poignonnec, say independent sales agents and sellers collobi wit staff of di company to do magomago as dem place orders wey dem come later cancel.
Di company say dem don sack di sales agents and remove sellers wey get hand for di wayo from dia platform.
Dis na anoda wowo tori for Jumia, afta dem join New York Stock Exchange dis year.
For May, one research by Citron accuse Jumia say dem be wayo; say di company do wayo for dia figures wey include to increase di number of active customers and merchants dem get.
Jumia dey like Amazon for Africa wit four million customers wey dey across 14 kontris at di end of last year.
End of Di one wey oda users dey read well well
Since dem launch for 2012, di company don lose reach $1 billion.