Elisha Abbo: Court don adjourn di Senator criminal assault case to August

Wia dis foto come from, Elisha Abbo
Published
Chief Magistrate Court for Zuba, Abuja Nigeria don adjourn di case of Senator Elisha Abbo to 20 August to hear di mata.
Senator Abbo dey face two count charge wey be criminal use of force and criminal assault.
Senator Abbo wey dey represent Adamawa North Senatorial District enta gbege afta CCT Video show say e beat one woman for one adult sex toy shop.
Di Police bin invite am before dem charge am to di Magistrate Court to face di law on top wetin dem suspect am for.
For im first appearance for court for 8th of July, e plead say im no dey guilty and di court grant am bail with 5 million naira.







