Nigeria Air force man return €37,000 wey im pick for ground

Aircraftman Bashir Umar

Wia dis foto come from, Nigeria Air Force

Wetin we call dis foto, Aircraftman Bashir Umar
Published
Read am in 1 mins

Nigeria Air Force dey plan to honour one of dia officer wey return €37,000, wey be about N12 million according to di kontri Central Bank.

According to tori, Aircraftman (ACM) Bashir Umar find di money inside parcel wen e bin dey security duty dey patrol with some of im colleagues.

Im use di number wey dey inside ontop di parcel take locate di owner.

Di honour wey NAF wan honour Umar na so e go inspire oda officers to always dey honest.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Tok-tok pesin Chief of Air Staff Air Marshal Sadique Abubakar don direct Chief of Administration Kingsley Lar to make arrangements to honour ACM Umar for showing example of integrity, one of di core values for Nigeria Air Force.

Dis no be di first time dis kain tin dey happun.

Last August, airport authorities for Lagos honour two security guards wey return bag of money and expensive items.