NYSC: Steps to register for 2019 Batch A National Youth Service Corps

Wia dis foto come from, NYSC
Published
Di National Youth Service Corps just announce say dem don start online registration for di 2019 Batch A of corp members.
NYSC say dia registration dey start from Monday, 4 March and dem dey end am for Tuesday, 19 March, 2019.
How you go do di waka for your 2019 Batch A registration

Wia dis foto come from, NYSC
- Di NYSC Portal for online registration na portal.nysc.org.ng
- If na di first time you dey register, just click on di "Mobilization Batch A, 2019".
- If you don register before but you neva complete di registration or you neva submit am, no create new account o. Just click for di "Login Here" button so you go fit continue from wia you stop wit di username and password you dey use before.
- Di revalidation link na for only if you don already get mobilized for 2018 Batch "C" or oda Batche dem before now but you neva enta Orientation Camp.
- No thumb print for anoda pesin.
- You fit apply for name correction for dashboard.
- Make sure say di passport pishure wey you use dey very clear.
- No forget di username and password wey you use for your online registration.
- Make sure say you go through wetin you write for di submission so no wrong details go dey.
- For di latest for NYSC registration or new informate or latest tori, enta dia social media pages.

Wia dis foto come from, NYSC








