You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Valentine's Day: 5 Countries wey you no fit celebrate am
Valentine's Day wey most people and countries dey celebrate February 14 of every year to show love no be something wey some countries want make dia citizens observe.
Authorities for dis places dem don go as far as to ban di celebration, make anybodi no promote or even celebrate am. Make we see dis country dem.
Pakistan
For di second year, Pakistan don put ban any event wey dey promote Valentine's Day and dem even warn television and radio stations make dem no carry or cover tori about di event.
Na Islamabad High Court first introduce di ban last year, after one citizen carry complain say di holiday na culture from di West and e dey against di teachings of Islam.
Saudi Arabia
For Saudi Arabia, di kingdom religious police don ban celebrations. E fit lead to serious punishment if dem catch anybodi dey jollificate for Valentine's Day.
Na taboo for man or woman to show affection for public, as e be say dem dey sit down separately for restaurant, so di country say di idea of Valentine Day, no follow with dia belief.
Indonesia
Officials and Muslim clerics for Indonesia wey dey argue say Valentine's Day dey promote casual sex and drinking of alcohol, no too dey happy about di celebration.
Although some people still dey celebrate for di country but on Wednesday 14 February dem don ban di celebration for some of dia cities.
End of Di one wey oda users dey read well well
Iran
For recent year, authorities for Iran dey plan to forbid Valentine celebration - dem say di holiday na Western custom and dem still warn shops and restaurants say dem go deal with dem if dey sell Valentine Day gifts.
India
For India, plenty political parties dey criticise Valentine day. Dis ones dey argue say e dey promote Western values and dem no go welcome am inside di country.