Arsenal vs Man United: Odegaard to challenge Emile Smith Rowe? Quiet Fernandes in goalless draw

Arsenal vs Manchester United

Wia dis foto come from, Getty Images

Published

For years Manchester United and Arsenal don challenge for di biggest trophies for England and on Saturday night both of dem show say dem fit dey on di right path to challenge for di Premier League again afta period of quietness on di trophy front.

Di two teams play entertaining goalless draw for Emirates stadium for dia matchday 21 fixture for Premier League.

Both sides bin get good chances to score but on di balance of play one point each na im di two teams settle for.

United go feel small sense of disappointment as dem again fail to win any of dia last two matches to stay top of di Premier League table.

For Arsenal, dis result show say di club decision to stick wit Arteta wen dem bin no dey win games fit don dey pay off.

So wetin we learn from dis draw between Arsenal and Manchester United?

United title challenge dey in danger

Afta di shock 1-2 defeat against Sheffield United for midweek, Manchester United bin need to bounce back from dat shock result to maintain dia push for di title.

Di loss to Sheffield United see Man City replace dem for di top of di table and wit City victory over di same club wey beat United on Wednesday, United now dey three points behind dia Manchester neighbours wey also get one outstanding game.

United need to arrest dis two-game winless run and put dia dreams of winning di title back on track starting wit dia next game against Southampton.

Injuries rob Arsenal of key players

Despite say dem play without some of dia key players, Arsenal look like di better side on di balance of play.

Wen di teamsheet for di match comot, many Arsenal fans no waste time to notice di absence of Bukayo Saka, Kieran Tierney and Pierre-Emerick Aubameyang from di Arsenal lineup.

According to di club, Saka get minor hip problem, Tierney miss di game wit calf complaint while Aubameyang bin dey absent for personal reasons.

Still, di Gunners hit di bar from Lacazette free-kick and also come close from scoring through Nicolas Pepe and Emile Smith-Rowe.

Martin Odegaard fit be Ozil replacement?

After e sign from Real Madrid on loan, not many pipo expect Martin Odegaard to make di Arsenal matchday squad let alone even play some minutes as substitute for di second half.

Although e no really influence di game for di few minutes e play, if ever im fit replicate some of di creativity of di outgone Mesut Ozil, Gunners fans go see im signing as huge success.

But first, Odegaard must find im way into Arteta starting eleven as di current pesin wey dey occupy di position - Smith-Rowe no look like e dey Arteta first team squad to make up di numbers.

Quiet Bruno Fernandes

Everyday dem say no be Christmas and dat statement fit apply to di United midfielder performance today for di Emirates stadium.

Fernandes na di reigning Premier League player of di month and wit eleven goals and seven assists dis season, United fans bin hope for di Portuguese to run di show against Arsenal.

But dat no be wetin happun as im bin dey quiet throughout di match just like im bin dey against Sheffield United on Wednesday.