Man United vs Copenhagen: Anthony Martial, Manchester United line up today, di big numbers dem get for Europa League ahead of FC Copehagen match

Published

Manchester United go face FC Copenhagen for Cologne on Monday evening as di Europa League enter di 'final-eight' stage.

Di Reds top group L with four points before dem see off Club Brugge and LASK, 6-1 and 7-1 on aggregate respectively, to qualify for di quarter-finals stage.

Check out di team statistics for Europa dis season ahead of dia quarterfinal match by 8pm.

Number of goals wey dem don score

Manchester United- 23

Basel - 20

Wolves- 19

Braga- 17

Sevilla-17

Total attempts on goal

Man. United-154

LASK- 154

Sevilla-138

Frankfurt- 135

Wolfburg- 133

Wetin Solskjaer tok about Martial?

Manchester United manager Ole Gunnar Solskjaer say make pipo "expect more " from Anthony Martial afta di Frenchman best season so far for im career.

Martial, wey be 24 years, score im 23rd goal of di season against LASK for Wednesday Europa League last-16 victory.

Im neva score more than 17 goals for a single season before and im total for dis campaign don double in last two seasons combined.

"Physically, im dey di best level of im career," na wetin Solskjaer.

Attempts on targets

Man. United- 55

Sevilla -55

Frankfurt- 50

Sporting CP-48

Basel-48

United dey unbeaten for 14 Europa League knock-out matches since dia 2-0 defeat to Liverpool for Anfield for di round of 16 for March 2016.

Since then, dem don draw with di Merseysiders for Old Trafford and beat Saint Etienne, Rostov, Anderlecht, Celta Vigo, Club Brugge and LASK over two legs, plus Ajax for 2017 Stockholm final.

In total dem get nine wins and five draws.

See oda stats wey you need to know

Most wins for Europa League (match)

23 Benfica

21 Sevilla

20 Atlético Madrid

18 Valencia

17 Villarreal

13 Chelsea

12 Ajax

12 Liverpool

11 Arsenal

11 Manchester United

Most goals scored

68 Benfica

64 Sevilla

64 Valencia

54 Atlético Madrid

50 Villarreal

41 Chelsea

39 Lyon

39 Manchester United

38 Athletic Club

37 Salzburg

37 Sporting CP

Biggest win (match)

7-1 Lyon v AZ Alkmaar (23/02/17)

6-0 Valencia v Rapid Wien (18/02/16)

5-0 Man. United vs LASK (12/03/20)

5-0 United v Club Brugge (27/02/20)

5-0 Valencia v Basel (10/04/14)