You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Man United vs LASK: See where you fit watch di Europa League match
Manchester United go resume dia UEFA Europa League campaign on Wednesday with di last-16 second leg match against LASK.
Di Reds dey go into dis match for Old Trafford with 5-0 advantage, afta dia strong performance for Austria during di opening leg for di club last game before lockdown start.
Dis na United last home game for di extended 2019/20 season, and di winner of dis tie go progress to di Europa League finals tournament, wey go happun for Germany.
Dis na eviritin you need to know ahead of di match.
Which station go show di match?
Wednesday game go dey live for cable company StarTimes Nigeria for World Football and kick-off na 8pm.
Who be di Referee?
Greek referee Anastasios Sidiropoulos na im go to officiate Wednesday match, im linesmen na Polychronis Kostaras and Lazaros Dimitriadis and fourth official Anastasios Papapetrou na him assistants.
Dem go use di Video Assistant Referee system during di match for Old Trafford, na Italians Paolo Valeri and Maurizio Mariani go dey responsible to give second eye.
Possible teams to face for di next round?
If United progress to di quarter-finals for Germany, dem go face either Istanbul Basaksehir or FC Copenhagen for one legged quarter-final. Di two teams go face each oda for di Danish capital and na recently crowned Turkish champions Basaksehir dey carry slim 1-0 lead into dis match afta di first leg.
End of Di one wey oda users dey read well well
Oda matches on Wednesday
- Shakhtar Donetsk (2) v (1) Wolfsburg (17:55 BST)
- FC Copenhagen (0) v (1) Istanbul Basaksehir (17:55 BST)
- UNITED (5) v (0) LASK (20:00 BST)
- Internazionale v Getafe* (20:00 BST)