Man City vs West Ham: Bad weather force Premier League to cancel Sunday match

Published
Read am in 1 mins

Dem don postpone Manchester City Premier League match against West Ham wey suppose hold on Sunday.

Manchester City wey dey second place for Premier League table suppose host West Ham by 5:30pm but di club say di match now go hold on another date.

Dis na becos of wetin di club describe as "extreme weather conditions wey Storm Ciara dey cause for United Kingdom."

Premier League say di new date of di match now go be on Wednesday 19 February, 2019.