Man City vs West Ham: Bad weather force Premier League to cancel Sunday match

Premier League cancel Man City vs West Ham

Wia dis foto come from, Premier League

Wetin we call dis foto, Storm Ciara also affect League games for Belgium and Netherlands
Published
Read am in 1 mins

Dem don postpone Manchester City Premier League match against West Ham wey suppose hold on Sunday.

Manchester City wey dey second place for Premier League table suppose host West Ham by 5:30pm but di club say di match now go hold on another date.

Dis na becos of wetin di club describe as "extreme weather conditions wey Storm Ciara dey cause for United Kingdom."

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Premier League say di new date of di match now go be on Wednesday 19 February, 2019.