You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Chelsea vs Sheff Utd: Blades pocket point afta late Zouma own goal
Sheffield United fight back from two goals down to pocket one point after Kurt Zouma late own goal for Stamford Bridge.
Di hosts bin dey lead 2-0 by half-time afta striker Tammy Abraham strike two times for im third and fourth goals of di season.
But di Blades begin level up for di first minute of di second half wen Callum Robinson, wey bin don miss from close range for di first half, score im first goal since im join di club for summer.
Dem level up afta 89 minutes to deny Frank Lampard im first home win afta Robinson cross towards substitute Lys Mousset divert enta im own net by Zouma.
Dis result don put di visitors, wey finish second inside di Championship last season, for eighth position ontop di Premier League table, one place above Chelsea.
Chelsea go next visit Molineux to take on Wolves wen Premier League return afta di international break, on Saturday 14 September. Di Blades go host Southampton for Bramall Lane on di same date.
Meanwhile Man United draw 1-1 with Southampton, Man City beat Brighton 4-0, Leicester beat Bournemouth 3-1, Crystal Palace win Aston Villa 1-0, Newcastle draw 1-1 with Watford, West Ham beat Norwich 2-0, while Liverpool thrash Burnley 3-0.