Nicki Minaj don marry her boo, Kenneth Petty

Wia dis foto come from, Nicki minaj
Nicki Minaj don marry her bobo of less than one year, Kenneth Petty.
She announce am on Tuesday for inside social media wia she add her Petty to her goment name, Onika Tanya Maraj, as she post picture of mugs wey get Mr and Mrs for dem and Caps wey dem write bride and groom for dem.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
Di Megatron star bin announce say di couple bin don get dia marriage license for June and go need to get married 90 days afta.
Di rapper tok say she and Petty don be friends from childhood afta plenti pipo start to dey hala on top im criminal past as e be registered sex offender.
Nicki Minaj bin drop message for September for inside Twitter say she dey retire from music so she go fit concentrate on her family.
And as at now, she currently dey run her new Queen Radi show for Apple Beats 1.
According to jollification tori pipo, E! News, di next tin wey she dey focus on now na pikin even as rumour sef don dey fly say she get belle.
Before Petty, Nicki Minaj bin date rapper, Meek Mill for two years.
End of Di one wey oda users dey read well well










