Di Nigeria House of
Representatives say dem go give Nigeria Foreign Ministry all di support e need
to evacuate Nigerians back from Ukraine on Wednesday.
Di Speaker of di
House, Rep. Femi Gbajabiamila, give di assurance as e meet wit di Nigerian
Foreign minister, Geoffery Oyeama to yarn on di plight of of Nigerian wey dey
in dey in di middle of di Russian/Ukraine gbas-gbos.
Oga Gbajabiamila say di
evacuation suppose start dis Monday but dem gatz shift am to Wednesday to allow
di ministry, the House and di Nigerian foreign missions for
Ukraine, Poland and Russia to complete di formalities to move Nigerians
to safe borders wit neighbouring kontris.
Gbajabiamila, draw ear give
di minister say di way di kontri di respond to emergency no quick at all.
E explain give say e dey good
for di kontri to get response mechanism like earoplanes and oda equipment dem
including funds and dat di legislature go do legislation to include dis kain
emergencies in di future.
Nigeria foreign minister fo
im response say Nigeria get about 5,600 Nigerian students for Ukraine and dat
di delay to evacuate dem no becos di goment no ready and dat up to 80 percent
to 90 percent of kontris no believe say Russia go strike.
E explain further say im bin
dey in touch wit di ambassador and dem re assure am say notin go happun as need
no dey for evacuation plus di Ukranian goment no want most of di students to
leave since e go affect dem to go back.
E say dem don put
everitin togeda and from dia dem go put dem inside bus and
transport dem to di various airport to di kontri.
E say dem go use
Poland, Romania, Slovakia, Hungary and even Russia as exit point dem go
use to evacuate Nigerians.
"Wia we dey
now na to find out di exact number of Nigerians and agree on di
location wey we go use to evacuate dem” Onyeama explain.