If di Nigerian goment still dey pay subsidy for petrol, why scarcity still dey?
And why pipo dey buy petrol above di goment approved price?
Dis na di question motorists and pipo for dis oil-rich city for southern Nigeria.
Port Harcourt dey ask as dem still dey suffer fuel scarcity and long queues for filling stations for di oil rich city.
As di fuel scarcity for Port Harcourt enter di third week, NNPC Mega filling stations dey sell petrol at N162.50 per litre.
Many filling stations dey closed sake of say dem no get product to sell and di ones wey get dey sell petrol between N195 to N220 per litre.
Sake of dis, di Nigerian Union of Petroleum and Natural Gas Workers (NUPENG) for statement give petroleum products marketers 24 hours to revert to di official price of petrol.
Marketers dey sell petrol from depots at prices wey dey above di official rates and dis dey force illegal increase in pump price.
NUPENG National Treasurer Alex Agwanor tell BBC Pidgin say di 24 hours deadline expire midnight of Monday 28 February 2022.
Agwanor tok say di taskforce dem set up go swing into action to locate those depots and filling stations wey still dey sell above di approved prices.
"Di problem come from some depot owners and also from some stations, even those wey buy normal price wan take advantage of di situation to sell at higher price.
"Some prefer to sell for night when nobody go monitor dem or try to stop dem from selling at di higher price.
"So today our taskforce go visit both di depots and filling stations to see di ones wey dey sell above approved prices and sanction dem," Agwanor tok.
Chairman of Independent Petroleum Marketers Association of Nigeria (IPMAN) Rivers State, argue say di high price of petrol na sake of say tank farm owners dey sell at higher price to retail marketers.
Dr. Joseph Obele tok say nai make dem too dey sell at higher prices.
Obele say dia members no dey import fuel and dem no own tank farms.
E tok say PPMC wey dey import fuel dey sell to private tank farms owners wey IPMAN members dey buy from.
According to Obele, di cost rate wey PPMC dey sell to private tank farms na between N127 and N135 per litre.
"E go interest you to know say as last weekend, private tank farm owners dey sell to marketers at di rate of N170, N175.
"So marketer wey buy from private tank farm at di rate of N175 no go sell am for anytin less than N190, N200 per litre.
"So we no dey get di products at di official rates wey we suppose dey get am, wey be N148 per litre.
Na only wen marketers buy at N148 we fit sell at N165 per litre," Im tok.