You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Ukraine's president, Zelensky say Russian shelling dey affect evacuation for Mariupol

Latest news updates on Ukraine-Russia war and di big tori dem from around di world.

Live Coverage

  1. Senator Stella Oduah react to 'face-off' between Bianca Ojukwu and Ebele Obiano

    Senator Stella Oduah wey dey represent Anambra North don react to di kasala wey happun during di inauguration of Prof. Charles Soludo today.

    Di senator tweet say she " condemn in strong terms, di unwarranted attack against di wife of di illustrious son and our very own Ikemba."

    Di senator also condemn wetin she say na di "vulgar language" wey di former first lady wife use against Bianca Ojukwu.

  2. Why Putin dey attack Ukraine?

  3. Report say Hushpuppi do $400,000 fraud inside US prison na fake news

    Ramon Olorunwa Abbas aka Hushpuppi reported $400,000 fraud inside US prison no be true.

    US Department of Justice dismiss di report on Thursday wen dem react to di viral tori.

    Tori bin dey circulate for local media say di Instagram celebrity bin receive fresh charges.

    Director of Media Relations, United States Attorney's Office, Central District of California Mrozek Thom tell BBC Pidgin say di tori no dey true.

    But di viral tori bin claim say 'US prosecutors on Wednesday 16 March 2022 submit court documents wey show say im committed fraud and launder over $400k from behind bars.'

  4. Video show di moment wey yawa gas between Bianca Ojukwu and Obiano wife

    Video show di moments wey lead to di time wey yawa gas between Bianca Ojukwu and Ebelechukwu Obiano.

  5. 'Fix di light and fuel crisis' - Ortom fire Buhari

      • Author, Dooshima Abu
      • Role, BBC Pidgin, Abuja

    Di Benue state Govnor, Samuel ortom don say wetin Nigerians need no be apology from president Muhammadu Buhari but for im to fix di light and fuel crisis wey di bite Nigerians.

    Di govnor tell BBC Pidgin say any apology wey no dey backed wit action no make any sense.

    Dis na as President Muhammadu Buhari tell Nigerians sorry on Wednesday on top di wahala wey fuel scarcity and power outage don cause.

    For statement wey im Senior Special Assistant on Media and Publicity Garba Shehu release, e say im goment bin don successfully comot dis wahala for dia seven years for power and na “dip for di hydroelectric generation wey clash with technical and supply palava for thermal stations” bin cause di blackouts.

    But govnor Ortom say di president no fit sidon for London dey apologise and ask why e no fix di light wahala before e travel go London.

    "Why you no go get blackout wen di moni wey dem suppose use to repair di machine to take bring light, pipo don don chop am"

    "Apology don bring light? apology don bring food? apology don provide security?" im kwesion.

  6. Russia dey accused of shelling cultural centre near Kharkiv

    Tori be say survivors escape from di theatre wey Russia bomb for di Ukrainian city of Mariupol.

    Despite pictures of destruction from di scene, tori be say many civilians wey bin dey take shelter for di basement bin survive di Wednesday attack.

    Dem bin set aside di ogbonge Soviet-era building wey dey for Mariupol city centre, next to di Sea of Azov waterfront, as designated shelter for civilians. Sergei Orlov, di city deputy mayor, say up to 1,200 pipo bin dey dia. Human Rights Watch, bin say di number dey between 500 and 800.

  7. Wetin dey happun for Ukraine?

    In case you just dey join, see wetin you need to know about wetin dey happun for Ukraine.

    • Ukraine don accuse Russian forces say dem bomb one theatre wia civilians bin dey hide for di southern city of Mariupol.
    • Authorities for Ukraine also say at least 107 pikin dem don die since di begin of di invasion
    • Some 1.95 million pipo don run comot Ukraine to Poland since di war begin, di Polish Border Guard agency tok.
    • Ukrainian President Volodymyr Zelensky thank Germany for im assistance during one address for Berlin, but e tell lawmakers say dia support "come too late to stop war".
    • Di Kremlin tok say Russia negotiators dey put big energy into toks to reach potential peace deal with Ukraine.
    • Di Russian state TV journalist wey stage one anti-war protest during a live bulletin don tell BBC say she "no fit remain on di sidelines".
    • UK dey set to deploy di Sky Sabre missile system for Poland, along with 100 troops, Defence Secretary Ben Wallace don tok.
    • And Foreign Secretary Liz Truss tell BBC say "very, very strong evidence" dey say Russian President Vladimir Putin na "war criminal", afta comments wey US President Joe Biden make.
  8. 'Fighting for Ukraine dey beta dan living here' - Nigerian volunteer

  9. Ghana Prez urge police to treat road accidents like pandemic

    President Nana Akufo-Addo talk Ghana Police Service say dem for find intelligent ways to deal with road accidents in de country.

    De Motor Traffice and Transport Department (MTTD) provisional data dey show say between January and February alone, road accidents kill 469 people.

    “We for treat road accidents like global pandemic den take more proactive responsible attitude to deal with am” Prez Akufo-Addo talk.

    He lament say de growing exposure of pedestrians den motorcycles to road traffic casualties no be something authorities go fit overlook.

    Last weekend alone, three accidents snatch lives of victims for Eastern, Volta Region den Ashanti Region of Ghana where one groom die on en wedding day.

  10. Anambra State Govnor: Charles Soludo don take oath of office

    Govnor Charles Soludo of Anambra State don announce say di goment go collabo with private citizens wey wan provide infrastructure for di pipo of di state.

    E tok dis one for inside im swear-in ceremony for Awka today.

    Check out some fotos from di inauguration ceremony for di Anambra state Govnor, Professor Charles Soludo wey happen on 17 March, 2022 for di Goment House, Awka.

  11. PDP appoint three man committee to resolve Edo PDP crises

    Di National Executive Committee NEC of di Peoples Democratic Party PDP don set up a three man Edo State Reconciliation Committee to resolve issues for Edo State chapter of di Party.

    Di crises for Edo PDP naim cause gbas-gbos between Governor Wike of Rivers State and Obaseki of Edo State.

    For Communique wey di National Publicity Secretary Sebo Ologunagba sign at di end of di NEC meeting, members of di committee include Governor of Benue State Samuel Ortom as chairman with Delta State Governor Ifeanyi Okowa and Bauchi State Governor Bala Mohammed as members.

    Di 12 point Communique also show say di PDP don approve electoral guidelines for di conduct of primary elections and timetable for di 2023 general elections.

    Di NEC also say sale of expression of interest and nomination forms go begin by 17 March 2023 and show di prices of forms for various elective positions from State Assembly to President.

    Dem approve 50% reduction for nomination fees for youths ages 25 to 30 years for di various elective positions.

    Di NEC observe say na corruption for APC dey cause di fuel scarcity and collapse of national grid wey don affect economic activities for di country.

  12. Jussie Smollett don comot prison on bail pending im appeal

    American actor Jussie Smollett don comot from Chicago jail on top bond afta dem bin sentence am to 150 days for prison.

    Di former Empire actor, 39, bin appeal di judgement wey im bin get on top say im lie to police say im bin dey as victim of hate crime.

    E bin need sign aa bond of im own recognizance for $150,000 before dem allow comot di Cook County Jail.

    E no tok anytin as im comot di jail but im lawyers say dem dey very happy with di appeal justice ruling.

    Oga Smollett don always tok say di hoax mata, wey happun for 2019 for Chicago, dey real.

    Di actor, wey be black and gay, bin claim for January 2019, say two pipo bin attack am as e bin dey waka later for night shout racial and homophobic absue on am come pour chemical substance on im bodi and tie rope for im neck.

  13. Buhari don tell kontri pipo sorry on top fuel scarcity

    President Muhammadu Buhari tell Nigerians sorry on Wednesday on top di wahala wey fuel scarcity don cause.

    For statement wey im Senior Special Assistant on Media and Publicity Garba Shehu release, e say im goment bin don successfully comot dis wahala for dia seven years for power.

    President Buhari further add say “sufficient fuel supply don dey for some states wey don reduce queue for filling stations. For di coming days, we dey expect say dis go happun for di rest of di kontri.

    Di president also chook mouth on top di power outage for plenti parts of Nigeria.

    E say dem de handle di mata say na “dip for di hydroelectric generation wey clash with technical and supply palava for thermal stations” bin cause di blackouts.

    E tell Nigerians say di goment attention wey dem don chook inside dis mata dem go soon bear fruit.

  14. Welcome!

    God morning.

    Welcome to today live-text report of stories from around di world.

    Remember say: "Pesin wey use elephant set trap, na only im know wetin e wan catch."

    Dat na our proverb for taday to use welcome you.

  15. Good night!

    Na here we go end today BBC Pidgin Live page.

    So far, we don report say US go send $1bn in weapons to Ukraine.

    National grid wey collapse for Nigeria don recover according to di kontri's minister of power, Abubakar Aliyu.

    We also tell you say International Court of Justice don order Russia to stop di katakata for Ukraine.

    Na Jelilat, faith and Tamara bring una all di tori for today.

  16. Hundreds of civillians bin dey di theatre wey dem bomb - Mariupol official

    Mariupol deputy mayor tell BBC say Russian forces bomb one theatre wey hundreds of civillians bin dey hide from di kasala.

    Serhiy Orlov say na between 1,000 and 2,000 pipo bin dey di building and e neva dey clear l how many die for di attack.

    Di BBC no fit verify dis information by weself.

    Mariupol dey surrounded by Russian forces and about 300,000 pipo dey trapped inside without water, electricity or gas. Food and medical supplies don dey less more more, and Russia no wan allow humanitarian aid enta.

    Di city dey under Russian shelling since di war start and e don scata neighvbourhoods finish. Last week, dem attack hospital kill five pipo.

    Orlov also say Russia attack convoy of civilians wey bin dey comot di city and injure five pipo wey include one pikin.

  17. Hoodlums kill two prison wardens for dynamite attack for Okigwe

    Police for Imo State don confam say two Prison wardens don die after some hoodlums attack dem for Okigwe, Imo State, South East Nigeria.

    Police tok tok pesin CSP Michael Abatam tell BBC Pidgin say di hoodlums ambush di unsuspecting Wardens with dynamite attack for di motor wey dem bin dey drive and e kill two of dem on di spot while one dey injured.

    Abatam say security agencies don take over di area with patrols and investigation don begin to fish out di hoodlums wey dey involved.

  18. US go send $1bn in weapons to Ukraine

    Di White House don confam e go commit $1bn (£764m) to di direct transfer of weapons to Ukrainian forces.

    Biden say di continued support dey about "making sure say Ukraine go never be a victory for Putin".

    E note US security assistance to Ukraine over di past year - $650m in weapons and $350m in additional aid - amounts to "more dan we don ever provid before".

    Di newly-announced support includes drones, 800 anti-aircraft systems and 9,000 anti-armour systems, as well as machine guns, shotguns, grenade launchers and 20 million rounds of ammunition.

    Allies too don step up dia support to unprecedented levels, Biden add join.

    "We're go continue to stay di course and do everything we fit to push for an end to dis tragic, unnecessary war," he tok.

  19. ICJ don order Russia to stop di katakata, Di fight don nearly reach three weeks

      • Author, Tamara Ebiwei
      • Role, BBC News Pidgin

    Di International Court of Justice(ICJ) Judges don order Russia to suspend military operations for Ukraine.

    Dem say Russia must immediately stop military operations for Ukraine and make sure say military units or pipo wey dem dey support or control no take any steps again for di military operation.

    Both parties must stop from any actions wey fit increase di katakata pr make am hard to settle.

    Di Judges no gree order Russia to report back on progress, but International legal obligations to make Russia to do as dem tok.

    Ukraine President Volodymr Zelensky claim say na " complete victory" and tok say if Russia ignore di order e go dey on e own.