Babajide Sanwo-Olu react to election victory

Wia dis foto come from, Babajide Sanwo-Olu
Di Govnor of Lagos state Babajide Sanwo-Olu don thank di pipo of di state for im re-election.
Di govnor for inside statement afta Inec declare am as di winner of di Lagos state govnorship election say, “dis elections don deeply test us as a pipo. Dis victory no be just mine but e belong to every Lagosian.”
E say im don work hard to live to di responsibility of governing di most important subnational economy for Africa.
On some of di disruptions wey happun for some polling units for di state, Sanwo-Olu tok say e don direct law enforcement agencies and security agencies to ensure say anyone wey dey guilty go face di full wrath of di law.

Wia dis foto come from, Babajide Sanwo-Olu

Wia dis foto come from, Babajide Sanwo-Olu

















