How di govnorship and state House of Assembly elections happun across Nigeria
Sorting and voting start for many polling units as early as 3pm for some parts of di kontri.
Live Coverage
Helen Oyibo and Victor Ezeama
Rivers state APC govnorship candidate Tonye Cole cast im vote
Wia dis foto come from, Facebook/Tonye Cole
Di Govnorship candidate of di All Progressives Congress, APC, for Rivers State Tonye Cole don cast im vote.
Im vote for Polling Unit 2, Ward 12 for Abonnema Akuku-Toru LGA.
"So far, di election process for my PU dey smooth, and we hope say na di same across every PU for Rivers State." E tok.
NDLEA gbab suspected vote buyers
Wia dis foto come from, NDLEA/TWITTER
Operatives of di National Drug Law Enforcement Agency, NDLEA don gbab four party agents pipo wey carry plenti moni and credit cards.
Di officials wey dey election duty stop and search allege say di four party agents dey try buy votes for Ibara housing estate, Ogun state, according to what NDLEA post for social media.
Dem say each card contain 10k and go activate to cash wit one code.
Wia dis foto come from, NDLEA/ TWITTER
Delta state Govnor Ifeanyi Okowa cast im vote
Wia dis foto come from, Charles kosipre
Delta State Govnor Ifeanyi Okowa don cast im votes.
Di govnor cast im votes for polling unit 017/Ward 002 for Eghoma Primary school, Ika North East local government Area, during di 2023 Governorship Election.
Wia dis foto come from, Charles kosipre
Wia dis foto come from, Charles kosipre
Wia dis foto come from, Charles kosipre
Election workers, party agents complain of low voter turnouts for Kano
Article Information
Author, Mansur Abubakar
Role, BBC Pidgin, Kano
Wetin we call dis foto, Some election workers and party agents dey complain of low voter turn out for Kano
Some election workers and party agents for Kano state dey complain of low voter turn out for Saturday Govnorship and Assembly elections wey dey happun across Nigeria.
Some election workers for Babban Giji ward Polling Unit 47 tell BBC Pidgin say na 22 voters di unit get but na only one pesin don comot to vote as at 9:50 am.
Some party agents also tok say dem dey surprised about di low turn out adding say low momentum afta di presidential election and fear of violence fit be reason.
Across some oda places for Kano voting process dey go on without any hitch.
Na Kano state get di second highest number of registered voters for Nigeria after Lagos.
And many dey expect dis election to be a straight battle between ruling All Progressives Congress and di New Nigeria Peoples Party.
Across some oda places for Kano, voting process dey go on without any hitch.
Na Kano state get di second highest number of registered voters for Nigeria afta Lagos.
And many dey expect dis election to be a straight battle between di ruling All Progressives Congress, APC and di New Nigeria Peoples Party, NNPP.
Labour Party Govnorship Candidate for Rivers state don cast her vote
Wia dis foto come from, King Onunwor
Labour Party Govnorship Candidate, Beatrice Itubo don cast her vote, for Ward 1, Unit 6, Emohua LGA of Rivers State.
Election workers, party agents complain of low voter turnouts for Kano
Article Information
Author, Mansur Abubakar
Role, BBC Pidgin, Kano
Wetin we call dis foto, Some election workers and party agents dey complain of low voter turn out for Kano
Some election workers and party agents for Kano state dey complain of low voter turn out for Saturday Govnorship and Assembly elections wey dey happun across Nigeria.
Some election workers for Babban Giji ward Polling Unit 47 tell BBC Pidgin say na 22 voters di unit get but na only one pesin don comot to vote as at 9:50 am.
Some party agents also tok say dem dey surprised about di low turn out adding say low momentum afta di presidential election and fear of violence fit be reason.
Di moment Oyo state Govnor Seyi Makinde vote
Video from Ward 11, Unit 001, Iwo Road Ibadan wia Govnor Seyi Makinde cast im vote for di govnorship and house of assembly election.
PDP govnorship candidate for Rivers Siminialayi Fubara cast im vote
Wia dis foto come from, Jay Martinz
Govnorship candidate of di Peoples Democratic Party, PDP, for Rivers State, Siminialayi Fubara don cast im vote for im hometown, Opobo for Opobo/Nkoro local goment area of Rivers State.
Accord Govnorship candidate Dumo Lulu-Briggs for Rivers cast im vote
Wia dis foto come from, Susan Serekara Nwikhana
Wetin we call dis foto, Susan Serekara Nwikhana
Accord Govnorship candidate Dumo Lulu-Briggs don cast im vote for im home town Abonnema, Akuku Toru local goment area for Rivers state.
Fotos show wen Labour Party candidate for Lagos vote
Wia dis foto come from, GRV
Fotos show wen di Labour Party candidate for di govnorship election for Lagos state Gbadebo Rhodes-Vivour cast im vote.
E dey contest against di incumbent Govnor of Lagos state Babajide Sanwo-Olu wey dey hope for a second term.
Wia dis foto come from, GRV
Wia dis foto come from, GRV
Breaking, Labour Party candidate for Lagos Gbadebo Rhodes-Vivour don vote
Labour Party candidate for di Govnorship election for Lagos state Gbadebo Rhodes Vivour don cast im vote for polling unit 045 Anifowoshe Ikeja Lagos.
How di election dey waka for Makoko Lagos
Some fotos of how di election dey waka for Lagos riverine community Makoko wia residents dey vote.
Di moment Sanwo-Olu vote
Dis na di moment wen Lagos state Govnor Babajide Sanwo-Olu cast im vote.
E dey face opposition in di likes of Gbadebo Rhodes-Vivour of Labour Party and Abdul-Azeez Olajide Adediran aka Jandor of PDP.
Breaking, Lagos state Govnor Sanwo-Olu don vote
Lagos state Govnor Babajide Sanwo-Olu don vote.
E vote for Adeniji Adele Ward 15 polling unit 006 for Lagos state.
EFCC don show!
Operatives of di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC don begin land for polling units to monitor di process against mago-mago and vote buying.
Some of di officials show up for Ward 11, Unit 001, Iwo road Ibadan, Oyo state wia Govnor Seyi Makinde go cast im vote.
Wetin we call dis foto, EFCC Officials show face for one polling unit for Ibadan
Bola Tinubu don cast im vote
Wia dis foto come from, Twitter/@officialABAT
Nigeria Presiden elect Bola Tinubu don cast im vote.
E tok afta e vote for im social media account say im don exercise im civic duty for di govnorship and state assembly elections as e encourage odas to go out and vote peacefully.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
Nigerian actress allege say Inec change dia polling unit location
Popular Nigerian actor and social media influencer Omoni Oboli dey allege say Inec change dia polling unit from inside VGC estate for di high brow area of Lekki go express.
Inside her Tweet, she say na inside di park for inside di estate dem bin dey vote all dis years but Inec come today say dem no go fit enta di estate afta dem don set everywia say make dem go express go vote.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
Voting don start for ward 9 Oshimili North, Delta State
Voting don start for Ward 9, Mgbala primary school Oshimil North, local goment area of Delta State.
Di Electoral official first begin give numbers to allow voters based on first come.
Den afta, dem educate di voters before dem begin di voting process.
So far, di voting process dey go on smoothly for ward 9.
Meanwhile, one independent observer, Raphael Nwankwo wey follow BBC Pidgin tok say di polls for Okpanam, one community for Oshimili North dey go on well except for some machines wey no dey pick up alphabet.
Wetin we call dis foto, Raphael Nwankwo Independent observer
From my observation, we no get much challenges, everything dey go on smoothly apart from some machines wey no dey pick up some alphabet for unit 004."
"But Officials don assures us say with time those machines go react, say na based on di time wey dem take activate am," Raphael Nwankwo add.
'I trek over 4km to comot vote as motor no dey road’
Article Information
Author, Mansur Abubakar
Role, BBC Pidgin, Kano
Wetin we call dis foto, Maimuna Sani
Maimuna Sani tell BBC Pidgin say she trek over 4 kilometres to vote for Hausawa polling unit 47 Babbam Giji ward for Kano state.
Di woman wey spend over an hour before election workers finish arranging di place tok say she happy as she don vote and dey trek back to her house.
“I trek all di way from my house inside Sallari area to reach here but as I don vote, I dey go back house.”
Oda women Fatima Mustapha and Lubabatu Abdullahi also tok say dem dey satisfied with di process afta voting.
Fatima on her part add say make pipo wey dey house dey fear violence comot as notin bad dey happun.
Electoral official educate voters
Electoral official for For Ward 9, Mgbala primary school Oshimil North, local goment area of Delta state educate voters for di process to waka smoothly.
Di Electoral official dey do dis before dem go start di voting process for pipo to dey guided and no make mistake.