Peter Obi raise alarm of alleged planned protests by opposition in Obidients name

28 states go hold govnorship elections for Nigeria on Saturday 18, March, 2023.

Live Coverage

Victor Ezeama and Helen Oyibo

  1. Police order restriction of movement on election day, Di order no cover di federal capital territory as no election dey happun dia on Saturday

      • Author, Andrew Gift
      • Role, BBC Pidgin, Lagos
    Police IG

    Wia dis foto come from, Nigeria Police

    Wetin we call dis foto, Nigeria police IG

    Inspector General of Police for Nigeria Usman Alkali Baba don order restriction of movement during di govnorship and state house of assembly elections on Saturday.

    Di restrictions cover movement on roads, waterways and oda forms of transportation from 12am to 6pm on Election Day for di states wia di election dey happun.

    Di IGP say only pipo wey dey exempt from di order na pipo on essential duty like INEC officials, electoral observers, media pipo wit accreditation, ambulances and firefighters.

    Di order no cover di federal capital territory as no election dey happun dia on Saturday

    Di IGP say di ban on VIPs wit police escorts to polling booths on Election Day still dey in effect. Di ban also affect vigilantes, state and private security outfits.

  2. DSS arrest two suspects for Kano over call for violence

    Di two suspects

    Wia dis foto come from, DSS

    Department of State Services (DSS) for statement announce say dem don arrest two suspects Abubakar Tabula and Ismail Iliyasu Mangu for Kano state after dem allegedly call for violence ahead of govnorship election on Saturday.

    According to DSS di harmful messages wey di two pipo send na call for dem to attack pipo wey dey opposed to dem and also security pipo on March 18 2023 wey be election day.

    DSS say dem no go siddon watch some pipo wey get plans to cause kata kata for di state.

  3. 'Make sure say di BVAS machine work well' - Govnor Diri tell INEC

      • Author, Karina Igonikon
      • Role, BBC Pidgin, Port Harcourt
    Douye Diri

    Wia dis foto come from, Douye Diri

    Wetin we call dis foto, Bayelsa State Governor Douye Diri dey ginger pipo for di State to participate for di State Assembly elections

    Bayelsa State Governor, Douye Diri don ask di Independent National Electoral Commission INEC to address di logistics and poor performance of di BVAS machines wey affect di Presidential and National Assembly elections.

    Governor Diri tok dis one for State wide broadcast, wia e ginger pipo of di State to come out and vote for di State House of Assembly elections wey go hold for di State on Saturday 18 March 2023.

    Di Governor also appreciate di security for di State wey dem no record any death as well as di participation of di pipo for di Presidential and National Assembly elections wia all di candidates of di Peoples Democratic Party PDP win all di National Assembly seats and even for di Presidential.

    E ask INEC to make sure say such challenges no repeat during dis elections as di major shift for di electoral process na di use of technology for electronic transmission of results from polling units to check fraudulent adjustments of figures at collation centers. Dis e say go increase confidence in di election process.

  4. Kano goment task security agencies on maintaining peace

    Govnor Abdullahi Ganduje
    Wetin we call dis foto, Govnor Abdullahi Ganduje of Kano state

    Kano state goment don comot to tell security agencies to try dia best to maintain peace ahead of Saturday govnorship election for di state.

    For statement wey commissioner of information Muhammad Garba release, di goment tok say dem get informate say some pipo dey try cause kata kata for di state na why dem dey ask security pipo to do dia work.

    Di election for Kano dey expected to ebe one of di hottest across Nigeria as di two main contenders Nasiru Yusuf Gawuna of di APC and Abba Kabri Yusuf of NNPP battle to become Kano state govnor.

    Na Kano state get di second highest number of registered voters for Nigeria after Lagos state.

  5. INEC don begin distribute materials for Govnorship election for Abia State

    Foto of election materials

    Di Independent National Electoral Commission (Inec) don start to distribute election materials ahead of di Govnorship and House of Assembly elections on Saturday.

    Di govnorship elections suppose happun last saturday 11 March, 2023 but Inec postpone am sake of BVAS configuration.

    Inec election materials
    Inec election materials
    Security pipo bin dey on ground during di distribution
  6. How di governorship election go run for Lagos despite Oro palava

  7. Media houses chop sanction for Nigeria sake of election offences, One station bin dey announce results ahead of di official announcement by di electoral commission

    INEC chairmann Prof. Mahmood Yakubu

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Nigeria don sanction about 25 broadcast stations sake of say dem fail to follow broadcasting laws wen dem dey cover di di Preseidential and National Assembly elections last month.

    Local media report say di National Broadcasting Commission (NBC) also give final warning to 16 oda broadcast stations for various poll-related offences.

    Dem accuse 17 broadcast stations say dem air partisan content 24 hours bifor di election.

    Three stations get sanction for inciting comments, while dem blame four stations for divisive ethnic or religious content.

    One station chop sanction say dem bin dey announce results ahead of di official announcement by di electoral commission.

    “Subversive discussions and reckless comments, wey dey capable of tearing us apart as a pipo bin dey go on air freely without proper gatekeeping. Dem throway ethics and professionalism overboard," di Director-General of NBC, Balarabe Ilelah, tok.

    Ilelah urged all broadcast stations to adhere to di provisions of laws on broadcasting ahead of di govnorship and state assembly polls wey go happun on Saturday.

    • E dey unfortunate say Oro dey move along wit INEC calendar - GRV

      GRV

      Wia dis foto come from, @GRVlagos/Twitter

      Labour Party govnorship candidate for Lagos State, Gbadegbo Rhodes-Vivour don call for di end to politicians to chose traditional rulers for di state in order for dem to fit "speak truth to power".

      Dis dey come on top tori say di Oro festival for parts of Lagos fit spill enta di March 18 govnorship election dey wey dey fear women voters pass.

      Gbadebo react for Arise TV interview say, "e dey unfortunate say dis Oro rights dey seen as going in line with di Inec calendar".

      Pipo don hala say dis festival fit cause voter intimidation as e fit make pipo no wan comot house for far of Oro.

      Howeva oga Rhodes-Vovour clear di air say dem don make arrangement for security, "especially for places wey voters don dey attacked before".

    • How gold for oil policy dey reduce fuel prices for Ghana

    • Opposition parties warn INEC against rigging for Rivers election

      Pipo wey call press conference for Rivers

      Wia dis foto come from, @TonyeCole1/Twitter

      Collabo of govnorship candidates from opposition political parties for Rivers State don promise to fight any attempt to rig di March 18 elections for di state.

      Di parties wey include di All Progressives Congress, di National Rescue Movement, Labour Party, African Democratic Congress and Action Alliance, bin accuse INEC say dem dey kolobi wit di state goment ot run dis election street.

      Di candidates for joint press conference call on di Commission to stop state goment officials, say make dem no get access to enta collation centres.

      Dem alsi ask INEC to make sure say BVAs work well dis time and results dey uploaded for polling units.

      Howeva, INEC don deny di claim say dem wan rig di election in favour of govnor Wike pesin, say dem dey very transparent.

      Skip X post
      Allow X content?

      Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

      Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

      End of X post

    • INEC promise us beta food but only give us appetizer - Peter Obi

      Peter Obi

      Di Presidential candidate of di Labour Party, Peter Obi don hala again about how di Independent National Electoral Commission fail to deliver for di February 25th election.

      For interview on TV dis morning Obi hala say wetin Inec do dey like "if pesin promise three course meal, come only serve you di starter, carry di remaining comot".

      Obi tok about how pipo bin dey ginger around the election process on top di introduction of BVAs to di mix as well as di amended Electoral Act but wetin happun during di election derep di kontri.

      Howeva, e say di mata still dey court and "Inec say dem go give us di materials afta di govnorship election".

      E hail di judicial system again say "Nigerian judiciary na one of di best for us, but na we politician and our transactional ways wan make sure say evertin dey corrupt".

      E say di plan na to leave beta kontri for Nigerians and na why im dey fight dis mata for court say, "By di election, we lost but we gatz give pipo beta kontri".

      On di mata of weda im go collabo with president elect Bola Tinubu, for im goment of unity plan, for dis beta kontri, e say, "I no dey for any collabo until tins dey don right."

    • AAC comot dem selves from di endorsement of Rivers PDP candidate

      AAC

      Wia dis foto come from, @aacparty/Twitter

      Di National Working Committee of di African Action Congress don suspend di executive committee of di Rivers State chapter of dia party.

      Dis dey come afta di endorsement of di govnorship candidate of di People's Democratic Party, Sir Siminialaye Fubara by di Inter-Party Advisory committee wia di state party wey dem say dia chaiman follow sign.

      Di party bin enta social media to distance demselves from di endorsement and so far don hire new interim comittee for di state.

      Dem don constitute steering committee of di AAC for di state to run di party in di interim,

      Rivers State dey field 15 candidates for di March 18 election wey dey run to replace outgoing Govnor Nyesom Wike.

      Skip X post
      Allow X content?

      Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

      Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

      End of X post

    • Una Good morning

      We welcome you to anoda day of our live coverage wit two days to di govnorship election.

      Na for 28 states Inec go conduct governorship elections on Saturday.

      Today na di end of campaigns ahead of di election.

    • New report put IPOB among top 10 deadliest terrorist group in di world

    • 'I wan be govnor for all Deltans' - Oborevwori

    • See you tomorrow!

      We thank una for staying wit us throughout today coverage.

      We go come back on Thursday.Goodnight.

    • Oro festival no go affect election – Lagos Monarch clarify

      Oro festival for Ikorodu

      Di restriction of movement for di Oro rites for Ikate-Elegushi kingdom, Eti-osa na from Wednesday to Friday, Lagos state monarch don clarify.

      Im make dis clarification afta tori dey go upandan say di festival rites go happun on Saturday, wey be gubernatorial election day and go restrict pipo movement.

      Oro na ritual rite wey be men affair for son of di soil alone. Women, pikin dem plus visitors no suppose show face for road at all until di festival end.

      For one Twitter post , di media aide Tope Oyefeso say election day no dey included.

      Di restriction na from 12midnight - 5am on each day, while residents dey free to move before and afta dis time, di media aide tok.

      Skip X post
      Allow X content?

      Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

      Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

      End of X post

    • 'Delta pipo go revenge PDP, APC for di govnorship election' - Pela

    • Women living wit disability send message to INEC, Over 10 million Nigerians dey live wit one form of disability or di oda.

        • Author, Andrew Gift
        • Role, BBC Pidgin, Lagos
      Women wit disability
      Wetin we call dis foto, Women wit disability

      Women living wit disability for Lagos state don call on di kontri election bodi INEC make dem ensure say pipo living wit disability participate for di govnorship election on Saturday.

      Leader of Network of women wit disability for di state Assumpta Kalil tell tori pipo on Wednesday say pipo wey dey live wit disability dey always dey sidelined for national activities.

      She call on INEC to include dia members as adhoc staff and oda roles.

      Over 10 million Nigerians dey live wit one form of disability or di oda. Di network say dem want make pipo wit Disbility get equal rights like evri oda Nigerian especially during di Saturday polls.

      Dem also call on INEC to ensure say di Saturday election dey credible and reflect di pipo’s wish.

      Women
      Wetin we call dis foto, Women wit disability
    • Federal High Court remand Reps member to police custody

      Federal High Court for Port Harcourt don reserve ruling on bail application for di money laundering case against house of representatives member for Port Harcourt constituency 2, Chinyere Igwe.

      Chinyere Igwe dey face money laundering charge afta police arrest am wit about $500,000 dollars and a list for di distribution of di money on 24 February, 2023, few days to di Presidential and National Assembly elections.

      Also, Principal prosecuting counsel from di Rivers State Attorney General office don take over prosecution of di case from police.

      Di court still remand am to Police custody.

      Chinyere Igwe

      Wia dis foto come from, Ayo Odungweru

      Wetin we call dis foto, Chinyere Igwe dey remanded to police custody