Millions of
Nigerians dey due to vote for di most competitive presidential election since
military rule end.
Since 1999,
Africa most populous kontri don dey dominated by two parties – di ruling APC
and di PDP.
But dis
time, e also get a strong challenge from one third-party candidate - di Labour
Party Peter Obi, wey dey backed by many young pipo.
Current
President Muhammadu Buhari dey step aside afta e don serve two four-year terms.
Im All
Progressives Congress (APC) dey represented by former Lagos governor Bola
Tinubu, while former Vice-President Atiku Abubakar dey stand for di main
opposition Peoples Democratic Party (PDP). Na total of 18 presidential
candidates dey di ballot.
Di election don
see huge interest from first-time voters and young pipo - one third of di 87
million eligible voters dey below 35 - wey fit lead to high voter turn-out than
di 35% wey dem record for 2019.
Voting dey
expected to begin at 08:30 local time (07:30 GMT), though anybody wey dey di queue
before e ends for 14:30 go still fit vote.
Dem dey also
hold elections for 109 federal senators and 360 members of di house of
representatives, and dat for govnors dey hold in March.
Di
Independent National Electoral Commission (Inec) don promise free and fair
elections, and dem don dismiss tok of postponement as pipo bin fear say insecurity
for parts of di kontri fit affect im preparations.
Dis na di
first time Inec go conduct national elections wit di use di Bimodal Voter
Accreditation System (BVAS), one facial and fingerprints technology wey dem
tink say e go improve transparency as e go make am harder for politicians to
rig di process.
Dem announce
final results on di third day afta voting for di last two elections,
but dem fit come in earlier dis time sake of BVAS, wey also dey upload vote
results directly to di Inec website direct from polling stations.
One
candidate need to get di most votes and 25% of ballots cast for two-thirds of
Nigeria 36 states to be declared as di winner
If no-one
achieve am, run-off go happun within 21 days – and dis go be first for Nigeria
history.