You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

How voting go across Nigeria during di 2023 presidential election

Nigeria vote who dia next leaders go be inside presidential and legislative elections.

Live Coverage

Helen Oyibo and Victor Ezeama

  1. Protest for Amuwo Odofin area of Lagos state as pipo no fit vote

    Some pipo for Amuwo Odofin, lagos, South West of Nigeria dey protest as both materials and electoral officials neva arrive as at 12:30pm.

    E no dey clear why but voting officially start since 8:30 for morning

    BBC Pidgin Andrew Gift dey report live from di area.

  2. Elderly pipo tok wetin dem want from presidential election winner

      • Author, Tunde Ososanya
      • Role, Journalist, BBC News Pidgin

    Elderly pipo for Onna Local Goment Area of Akwa Ibom State say anybodi wey win di presidential election gazz remember dem and make dia life easy.

    Chief Steve wey follow BBC Pidgin tok say im be 83 years and wetin im want be say make di winner of di election remember im and oda Nigerians so tins go dey easy for dem.

    Udia Saturday wey be 73 years say im want di winner to bring good tidings to Nigerians.

    One elderly woman, Joy Saturday, wey also follow BBC Pidgin tok say she want di presidential election winner to provide employment for Nigerians.

    One retired Master Warrant for di Nigerian Army, Harford John wey be 80 years old say wetin im want di presidential election winner to do na make e ensure say peace reign for Nigeria.

    Anoda elderly man Udo Sam wey be 85 years say na wetin go favour Nigerians di presidential election winner gazz do.

    52-year-old Emma Saturday say she want di presidential election winner to provide housing for Nigerians.

  3. 'Bodi dey sweet me as I come vote' - First time young voter, Many young pipo comeout to vote for di first time

      • Author, Tamara Ebiwei
      • Role, BBC News Pidgin

    Twenty-One year old Comfort Ezekiel na first-time voter, she say she wake up early mor-mor to come cast her vote.

    "I believe say my vote go count, na why I dey patient dey wait. E dey pain me say uptill now, officials neva come, but I must vote today"

    She say belle dey sweet her as she be part of pipo wey go choose leaders for Nigeria.

  4. 'I just pray say di election go well'- Chidera first time voter

      • Author, Princess Igho Williams
      • Role, BBC Pidgin

    Juwah Chidera Stella wey be 22 years old dey vote for di first time.

    Di first time voter wey carry her pet follow body to cast her vote dey hope say di election go waka well:

    "I just pray say di election go waka well because na wetin we want."

    Chidera go vote for ward 4 Asagba Secondary School, Umunkwo Asaba Delta State.

  5. Breaking, Kwankwaso don cast im vote

    D presidential candidate for di NNPP, Rabiu Kwankwaso don cast im vote.

    Di former govnor of Kano state vote for im polling unit for Madobi local govt, Kano state.

  6. 'Uptil now we neva see election materials and officers' - Abuja voters

      • Author, Tamara Ebiwei
      • Role, BBC News Pidgin

    Some voters for Abuja, Nigeria capital dey vex say uptil past 11:00a.m, dem neva still see Inec official.

    Di Aleyita Primary School Polling Unit don almost fill up wit plenti voters dey don dey wait since early mor-mor.

    Some women say dem leave dia children for house to come vote while oda nursing mothers tie dia pikin for back dey wait.

    Some voters para say na almost 12:00 noon dem neva see any official.

    "Until now, we neva see election materials, no official, di ones wey come say here say no be di place, say dem make mistake, dem waka go back" one voter tok.

    Inec Oga Prof Mahood Yakuby say voting suppose start by 8.30 but na almost 12 pm and no official don show face.

  7. 'City Boy' - Crowd, shout as APC Presidential candidate Tinubu vote

    Plenti crowd bin gada as APC presidential candidate Bola Tinubu cast im vote.

    Di crowd plenti sotay BBC tori pesin get to climb car to get beta view of am.

  8. Breaking, Peter Obi cast im vote for Agulu

    Di Labour Party Presidential candidate Peter Obi don cast im vote for Agulu town, Anambra.

    E arrive im polling unit 019, Ward 2 for Amatutu, at about 11:30am on Saturday.

    Im vote alongside wit im wife, Margaret Brownson Obi.

  9. E be like business as usual for some polling stations for Kaduna

      • Author, Onyinye Chime
      • Role, BBC News, Kaduna

    E be like business as usual for many of di polling stations for Kaduna metropolis.

    Pipo gada for much of di polling units but Inec official neva come.

    For some oda pipo, na business as usual as petty traders particularly food sellers dey sell dia market, odas set dey wait for buyers.

  10. 'I dey excited as first time voter'

      • Author, Princess Igho Williams
      • Role, BBC Pidgin

    First time voter, Chiamaka say she dey excited to vote for di Nigeria 2023 general elections.

    Chiamaka wey be 23 years old tell BBC Pidgin say she come di polling unit as early as 8:30 am but voting neva start.

    She go vote for Ward 5 Abuato Primary school Asaba, Delta State and dey hopeful say di election go Waka well without any palava.

  11. BVAS machine no allow Wike vote

    Di Govnor of Rivers State, Nyesom Wike never fit cast im vote sake of challenge wit di BVAS machine for im Polling unit for Ward 7 unit 9 Rumuepirikom, Obio Akpor LGA.

    INEC officials advise am make im return later as dem don invite dia technical team to check di device.

    Di Govnor bin dey dia wit im wife, Justice Eberechi Suzzette Nyesom-Wike to cast dia votes.

    E express disappointment wit di inability of di BVAS machine to function well and advise INEC to make sure say dia machines function well before election day.

  12. How di election dey waka for Asaba, Delta State

      • Author, Princess Igho Williams
      • Role, BBC Pidgin

    Pipo don tanda to cast dia votes for different wards for Asaba Delta State on top di presidential and National Assembly election wey dey take place today all ova di kontri.

    For ward 5 and 9 for Asaba, voters bin start to dey queue up as early as 7:00am but voting neva start.

    Dis na as INEC staff neva land di polling units.

    One voter for Ward 5 Abuato Primary School Asaba, Chinedu follow BBC Pidgin tok say im don dey wait since around past 7:00am.

    "Since afta 7:00 am wey I come till now wey be 8:48am, INEC neva still set up dia cubicle wey pipo go take vote."

    "Na only di NYSC adhoc staff don come but we dey still dey wait for voting to start so dat we go fit exercise our franchise," oga Chinedu tok.

    Meanwhile, security operatives dey on ground to make sure say di voting waka smoothly.

  13. Akwa Ibom Govnor Udom Emmanuel cast im vote

      • Author, Tunde Ososanya
      • Role, Journalist, BBC News Pidgin

    Govnor Udom Emmanuel of Akwa Ibom State don cast im vote for Awa Ward 1, unit 1 and 2, Onna Local Goment Are of di state.

  14. President Muhammadu Buhari cast im vote for Daura

      • Author, Olaronke Alo
      • Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin

    Nigeria President Muhammadu Buhari don vote for im constituency for Daura town for Katsina state.

    Di president wey come out at about 9:30 for morning cast im vote togeda wit im wife, Aisha Buhari.

    Muhammadu Buhari dey complete im eight-year term of office dis year, wia im dey set to hand ova power on May 29, 2023.

    Di kontri national television station tweet di moment Buhari cast im vote

  15. Okowa don cast im vote

    Delta State Govnor and di Vice Presidential Candidate for di PDP don cast im vote.

    E vote for Polling Unit017/ Ward 002 for Egbohoa Primary School, Ika North East local government Area, Delta State

  16. Watch: Di moment Atiku vote

    Watch di moment di Peoples Democratic Party, PDP candidate Atiku Abubakar vote for di election.

  17. Breaking, Tinubu don cast im vote

    Presidential candidate of di All Progressive Congress, APC, Bola Tinubu don cast im vote for Ikeja, Lagos state.

    E arrive di polling unit alongside im wife, Remi Tinubu. She also don cast her vote.

  18. ‘E dey discouraging say INEC staff neva show face’

      • Author, Tunde Ososanya
      • Role, Journalist, BBC News Pidgin

    At 10:00 am voters for Ward 4, unit 018, National Open University for Uyo, Akwa Ibom State voters still dey wait for INEC staff to show face as voting suppose don start.

    Some of di voters wey follow BBC Pidgin tok say dem don dey for di polling unit since 7am.

    First time voter wey identify herself as Grace say e dey discouraging say INEC officials neva show face but e no go discourage am to come back for di govnorship and state house of assembly elections.

  19. EFCC officials spotted for Tinubu polling unit

    Di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC tanda gidigba for di polling unit of di All progressives Congress, APC presidential candidate, Bola Tinubu.

    Di officials of di anti-graft agency also dey across polling units for di kontri as di Nigeria presidential election dey happun.

    EFCC deploy staff to monitor di election and stop any financial mago-mago wey fit happun to alter di outcome of di election.

    Meanwhile, for Bola Tinubu polling unit, voting neva start.

  20. ‘We want our votes to count’, Polling units dey set up for Rumuwoji town hall

      • Author, Karina Igonikon
      • Role, BBC Pidgin, Port Harcourt

    Election materials just arrive Rumuwoji town hall, Port Harcourt LGA Rivers State wey get plenti polling units for award 11, 12 and 13 PHALGA.

    Some early voters wey come to cast dia votes tell BBC Pidgin say dem dey determined to cast dia votes becos dem want Nigeria to change.

    Benibo na first time voter. E dey disappointed say election materials bin never arrive im polling unit by 8;00am as e come out early to cast im ballot. E dey determined to vote dis time around becos, “di suffering too much! Before, I no boda becos tins dey go well, we dey mange, but now, no. I must vote for tins to change.”

    Ma Victoria Briggs wan make di new goment make garri cheap so poor man go see am chop. She want make goment look into pensioners mata too, increase di money and bring work for di young ones.

    “Dis days, children go school finish no work, e no good na. So we want dis new goment to make life easy for us. We dey suffer.”

    For Francis Nwogu wey don voter many times before, e want make goment make sure say dia votes count.

    “We don see before wey pipo vote di pesin dem want but na sometin go happen and anoda pesin wey you no expect go enta office. I want make INEC assure us say dis time around, our votes go count.”