Tanker drivers suspend dia strike for Rivers State, Di 9 days strike by tanker drivers cause fuel scarcity for di oil rich city
- Author, Karina Igonikon
- Role, BBC Pidgin, Port Harcourt

Tanker drivers don suspend dia nine days strike for Rivers State, South South Nigeria.
Dis dey come afta one meeting dem hold with di Rivers State Commissioner of Police, Eboka Friday late Thursday evening for Police Headquarters, Port Harcourt, Rivers state.
For di communique dem sign, CP Eboka direct di release of all trucks wey dey seized say dem no carry illegally refined petroleum products and also set up a taskforce to arrest all illegal taskforces.
Di Tanker drivers strike cause fuel scarcity for Rivers State wey result to increase in di price of fuel to about N300 to N350 per litre.
Many filling stations bin dey closed and black market sales of fuel boom as pipo buy petrol between N300 to N500 per litre for black market, wey come also make transport fares to double.
Di Tanker Drivers bin strike becos of plenti harassment dem dey suffer for security operatives hand and di internal crises wey dey di Independent Petroleum Marketers Association of Nigeria IPMAN, but with di suspension of di strike, tankers go begin load products from di different depots and tank farms to effect supply.


















