You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Nigeria give citizenship to 286 foreigners

Live updates of top tori dem from Nigeria, Africa and across di world.

Live Coverage

  1. Fotos of Yemi Osinbajo for President Ruto swearing-in ceremony in Kenya

    Nigeria Vice president Yemi Osinbajo bin dey among di African leaders wey attend di swearing-in ceremony of President William Ruto of Kenya.

    Di swearing-in ceremony take place on Tuesday for Moi International Sports Stadium, Nairobi.

    According to di electoral commission, President Ruto win wit 50.5%. to beat Raila Odinga wey get 48.8% of di vote.

  2. Zambia Chief prosecutor raise alarm over threat to life

    Zambia Chief State Prosecutor say her life dey in danger afta goment withdraw all her security.

    Lillian Siyunyi, wey di former goment bin appoint no get relationship wit di new administration wey dey complain about her professional conduct for di Judicial Complaints Commission (JCC).

    She don refuse to appear before di JCC arguing say President Hakainde Hichilema need to lift her constitutional oath of secrecy before she fit appear before di body.

    As one of di highest constitutional office holders for Zambia, di Director of Public Prosecutions swear oath of secrecy wey say: "I no go directly or indirectly reveal or transmit any information or mata wey I sabi sake of di position wey I hold except wit di authority of di president."

    Ms Siyunyi tell BBC say both di president and di attorney general don deny her request.

    She complain say despite di waiver wey dem deny her, di JCC bin don start wit di hearing of di complain against her.

    Siyunyi add say if she respond to any of di charges against her before di lifting of her oath of secrecy, e mean say she don break law be dat.

    “I don get to escape from my house on more dan three occasions” afta threats from known 'operatives'."

    “I no dey tok say I dey above di law but say dia must be total compliance wit di provisions of di constitution of Zambia wey we must all uphold if we need to uphold di rule of law and protect human rights for all,” she tok.

    Presidential spokespesin, Anthony Bwalya, neva respond to BBC query on di mata since last week.

    On Monday, Information Minister and Chief goment Spokespesin, Chushi Kasanda, refer all questions to Justice Minister Mulambo Haimbe wey neva also respond to BBC enquiry.

  3. Who get invite - and who no get to Queen Elizabeth burial?

  4. Sudan delay school opening sake of floods

    Sudan don postpone di opening of schools due to di floods wey dey affect many parts of di kontri.

    Di school academic year, wey bin dey due to begin dis month across di kontri, now don dey pushed back to di to 2 October, local media quote di Education Minister Mahmud Sir al-Khatim al-Huri say e tok.

    At least 623 schools don dey affected by di floods and di delay for di school calendar na to allow dia reconstruction and rehabilitation.

    Heavy rains and flash floods don kill over 100 pipo and destroy thousands of homes in more dan a dozen states for Sudan in recent week

  5. Ukraine dey target east afta dia ogbonge counter-offensive

    Ukrainian officials say dem dey target towns for di eastern Donbas region afta dem make some gains for inside one fast counter-offensive.

    In recent days, Ukraine army reclaim some occupied territory, dis wan force Russian troops to retreat.

    President Volodymyr Zelensky say im forces dey fortify dia hold over 8,000 sq km (3,088 sq miles) of territory dem retake for di Kharkiv region.

    US President Joe Biden say Ukraine bin make "ogbonge" gains.

    Mr Biden say e dey "clear" say di advance get success, but caution say di offensive "fit take long".

    While Russia still control around one fifth of Ukraine territory, towns for di Donbas wey fall early for di war now dey under threat from Kyiv advancing forces.

    Afta dem fail to capture cities across di kontri, including di capital Kyiv, Russia don dey focus on di Donbas, parts of wey bin dey heavily already under di control of Russian-backed rebels before Russia launch im invasion dis year.

  6. New Kenyan president signal end of subsidies

    For im first day for office, Kenya President William Ruto give orders to reverse some of di policies of im predecessor, Uhuru Kenyatta.

    President Ruto appoint six judges wey dey nominated by di Judicial Service Commission three years ago, wey Mr Kenyatta don snub on claims say dia way no straight.

    Di six judges go dey sworn in on Wednesday.

    Di new president also indicate say e go scrap food and fuel subsidies. E say dem dey costly and ineffective.

    Mr Ruto also say all cargo clearance go dey reverted to Mombasa port - a roll back to Mr Kenyatta order wey make dem transfer port services to Naivasha to ensure repayment of a Chinese loan wey dem take for di construction of a railway between di port of Mombasa and di capital, Nairobi.

    Di policy positions be part of Mr Ruto campaign promises.

  7. Nigerian students go continue wit dia protest today

      • Author, Andrew Gift
      • Role, BBC Pidgin, Lagos

    Nigerian students under di joinbodi of di National Association of Nigerian Students, NANS southwest region go today continue wit dia protest against di strike by di Academic Staff Union of Universities wey don reach seven months now.

    Dis time dem dey go Iwo Road for Ibadan, Oyo state.

    On Tuesday, dem bin block di Lagos Ibadan expressway by Sagamu axis to protest di ongoing ASUU strike.

    Dem dey demand di immediate sack of di Nigeria Minister of Education Adamu Adamu and im colleague for di Ministry of Labour Chris Ngige.

    Dem carry placards and dey sing songs, say dis na just di beginning of many plans dem get to make goment listen to dia plight.

    Di protest cos heavy gridlock for di highway, cars and lorries no fit come in or out of Lagos. Di highway na major access route into Lagos Nigeria commercial capital

    Di gridlock start at about 11am Tuesday morning, as at 12 midnight same day, cars still dey struggle to pass through the gridlock even wen di students don disperse.

    Nigerian government owned universities don dey on strike for almost seven months. Efforts to resolve di strike between goment and leadership of di lecturers never get head.

    Di students say na dem dey on di receiving end of di strike and moving on, dem no go sidon one place di mata dey bad more.

  8. Court give order for DSS to detain Mamu

    Presiding Justice Evelyn Maha of di Federal High Court on Tuesday grant di motion ex-parte wey counsel for DSS, Ahmed Magaji bring seeking to detain Desert Herald publisher Tukur Mamu for 60 days pending dia investigations.

    Dem first arrest Mamu on September 6 for Cairo, Egypt as e dey with im family and dey try reach Saudi Arabia from dia.

    Di publisher dey serve as media aide to Islamic cleric Sheik Ahmad Gumi and na im lead negotiations unto di release of some of di passengers of di Abuja-Kaduna train wey gunmen kidnap on March 28 2022.

    For affidavit to support dia ex-parte motion with number FHC/ABJ/CS/1617/2022 filed before di court, DSS describe Mamu as logistic supplier to both local and foreign terror groups.

  9. Una good morning!

    Welcome to our live page coverage today.

    Na here you go get all di top stories from Nigeria, Ghana Africa and across di world.

    Good morning.