You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Nigeria give citizenship to 286 foreigners

Live updates of top tori dem from Nigeria, Africa and across di world.

Live Coverage

  1. Ukraine President Zelensky survive car accident

    Ukraine President Volodymyr Zelensky don survive inside car accident.

    Dis na according to im tok-tok pesin, Sergii Nykyforov wey reveal say na passenger motor jam di presidential car and im escort for di capial, Kyiv.

    E say, "di doctors don check di and dem no find serious injury".

    Di driver of di motor wey jam presidential motorcade collect treatment for di scene of di accident and dem don comot from di ambulance.

    Oga Nykyforov say all di traffic accident circumstances go dey investigated by law enforcement officers.

    E no tok pass dat one.

    Dis dey come one day afta President Zelensky bin go di recaptured city of Izyum for north-eastern Ukraine on Wednesday.

  2. 'Telling di bees' and oda unusual royal traditions afta Queen Elizabeth II die

  3. Wetin di Royal Family dey do today?

    Afta almost a week of di highest-profile activity, di Royal Family go get some sort of quiet time as authorities dey ready for di state funeral on Monday.

    Di focus of many go be on di Queen lying in state for Westminster Hall.

    But di Royal Standard no longer dey fly above Buckingham Palace, as di King dey back in Highgate for Gloucestershire.

    E no get official engagements today, but e don dey take calls from world leaders since di procession yesterday.

    Those calls, state business and catching up on di work wey e push go one side sake of di transition na wetin go sum up im day.

    Di Prince and Princess of Wales go travel go Sandringham to look di floral tributes wey pipo leave dia and di Earl and Countess of Wessex, Edward and Sophie, go visit Manchester. More details about di funeral dey expected later today.

  4. Chelsea struggle, PSG, Real Madrid late winner and Erling Haaland goal headline champions league night

  5. Why dis billionaire wey get fashion retail Patagonia dey dash im company to charity

  6. Kenya fuel prices go up as authorities comot subsidy

    Di cost of fuel for Kenya don rise to a new record high afta goment partially remove subsidies wey bin dey help consumers not to feel di bite of di global hike in oil prices.

    Di energy regulator tok late on Wednesday night say dem don remove di subsidy for super petrol, while dem retain a smaller subsidy for diesel and kerosene.

    For di new prices, super petrol – wey dey mostly used by private motorists – go now cost about 179 shillings ($1.5; £1.3) a litre, up from 160 shillings while diesel, wey transporters and industries dey use go cost 165 shillings for di capital, Nairobi.

    Kerosene, wey na mainly di low-income households dey use for cooking and lighting, go cost about 148 shillings.

    Dis wan dey come afta President William Ruto indicate for im inaugural speech say im administration go comot fuel and food subsidies, e say dem dey costly and no dey effective.

    But concerns bin dey say a complete removal of di subsidies go hit di economy hard as di fuel prices dey directly affect di cost of living.

  7. Govnor Sanwo-Olu sign Queen Elizabeth II condolence register

      • Author, Andrew Gift
      • Role, BBC Pidgin, Lagos

    Govnor Babajide Sanwo-Olu of Lagos state don join list of Nigeria goment officials wey don sign condolence for di death of Her Majesty Queen Elizabeth II.

    Di govnor attend di service of commemoration in honour of di Queen for Lagos.

    Govnor Sanwo-Olu say di Queen live a remarkable life of service, devotion and duty to di pipo of United Kingdom.

    E pray for di Royal Family, add say e go good if King Charles di III reign make strong di relationship and partnership between di UK and Nigeria.

    Earlier, top Nigeria goment officials don go sign di condolence register for Abuja.

    Dem include Nigeria president Muhammadu Buhari wey Secretary to Goment of di Federation Boss Mustapha represent plus di Speaker House of Representatives Femi Gbajabiamila.

    Church of Nigeria dey organise Remembrance service for Her Majesty Queen Elizabeh II for di Cathedral Church of Advent, Life Camp, Abuja on Thursday morning.

  8. How 'End Sars' help my broda get justice afta dem kill am for 2017

  9. R. Kelly dey guilty of child sexual abuse and child pornography

    Authorities don find American singer R. Kelly guilty on six counts of producing child pornography and enticing underage girls for sex.

    Di decision come afta four weeks of testimony with video wey show di singer dey molest one 14-year-old girl.

    Dis go be di second federal trial wey di disgraced artiste dey face.

    Di trial bin focus on one child pornography mata wey dem bin free di singer from for 2008.

    But last month, di girl wey dey di footage come testify say R. Kelly bin abuse am hundreds of times before she turn 18.

    Kelly dey already serve 30 year prison sentence for sex trafficking and racketeering.

  10. Una good morning!

    Welcome to our live coverage of news from around di world today.

    Na here we go bring you all di latest from Nigeria, Ghana, Africa and di world as e dey happun.

    Good morning.

  11. NANS protesters demand make dem call off Asuu strike kia-kia permanently

  12. Una bye-bye

    Na for here di BBC News Pidgin live page team go march break wit updates from Nigeria, West Africa and di World.

    We go return on Thursday, but for now you fit check out di latest BBC Pidgin Minute or tori for we website.

  13. Supreme court confam Odii as Ebonyi PDP Govnorship candidate

    Supreme Court don confirm Ifeanyi Odii as di Governorship Candidate of di People’s Democratic Party for Ebonyi State.

    Dis judgement mean say na Oga Odii go fly di party flag for di 2023 gubernatorial election.

    Di na afta di highest court for di land strike out di judgement of di Court of Appeal for Abuja on Wednesday.

    Di Appeal court bin declare Senator Obinna Ogba, as di Governorship Candidate.

    Justice Amina Augie wey head di five-man panel say senator Ogba no get di right of Appeal.

    According to her na becos im no bin dey part of di case wen dem carry di matter go court for Abakaliki, wia dem upturn Ogba candidacy.

  14. Police brutality: National Human Rights Commission compensate victims, Nigeria goment compensate di victims wit almost 300 million naira

      • Author, Tamara Ebiwei
      • Role, BBC News Pidgin

    Di National Human Rights Commission for Nigeria don tell victims of police brutality 'sorry' for all di pains and trauma wey dem don face.

    Executive secretary of di commission, Anthony Ojukwu tok for Abuja on Wednesday say di compensation dey "significant and na dream fulfilled".

    Im follow tok say to pay compensation to victims of police brutality na to acknowledge say di rights of pipo bin dey violated and na sign of apology to di victims from di goment.

    "Make dem no see di money say e represent di actual cost of di violations or harm wey victims suffer, na improvement in efforts towards di protection of human rights."

    Chairman of Governing Council, Dr. Salamatu Suleiman say di work start almost two years ago wit almost 300 victims and petitioners.

    Na total of 74 beneficiaries dem compensate wit almost 300 million naira.

    Di petitioners and victims bin go complain afta di Endsars protest for 2020.

  15. Man United don announce dia Premier League squad

    Manchester United don confirm dia 25-man squad list for di 2022/23 Premier League season.

    Dem make di announcement afta di summer transfer window close on September 1.

    Erik ten Hag select 25 players to represent United for dia Premier League fixtures dis season wey also bin im first.

    Di Dutchman bin recruit six new players ova di summer, dem be Martin Dubravka, Tyrell Malacia, Lisandro Martinez, Casemiro, Christian Eriksen and Antony.

    All of dem dey di list for di 2022/23 season.

    But United no include Phil Jones for dis season squad.

    Goalkeepers

    • Nathan Bishop
    • David De Gea
    • Martin Dubravka
    • Tom Heaton

    Defenders

    • Diogo Dalot
    • Victor Lindelof
    • Harry Maguire
    • Tyrell Malacia
    • Lisandro Martinez
    • Luke Shaw
    • Axel Tuanzebe
    • Raphael Varane
    • Aaron Wan-Bissaka
    • Brandon Williams

    Midfielders

    • Casemiro
    • Christian Eriksen
    • Bruno Fernandes
    • Fred
    • Scott McTominay
    • Donny van de Beek

    Forwards

    • Antony
    • Anthony Martial
    • Marcus Rashford
    • Cristiano Ronaldo
    • Jadon Sancho
  16. Sad procession begin lying-in-state ceremony for Queen Elizabeth II

  17. Rivers state magistrate court remand 'fake' Reverend sister for prison

      • Author, Karina Igonikon
      • Role, BBC Pidgin, Port Harcourt

    One magistrate court for Port Harcourt, Rivers State capital don remand one alleged fake Reverend Sister to di Port Harcourt correctional centre.

    Di suspect dey face 42 counts charge wey include one count charge for murder; 39 counts charge for child stealing and two count charge for false representation as Reverend Sister.

    Wen di matter come before Chief Magistrate Menenen Poromon, e say no get jurisdiction to entertain count one and ask di prosecution team to go back and separate di charges.

    E also refer di matter to di Director of Public Prosecution (DPP) for further investigation and adjourn di mata to 10 December 2022 for DPP advice.

    Na last week Tuesday, police for Rivers State parade di suspect wit some children wey dem claim say she kidnap for dia headquarters, for di capital.

    Some of di children don reunite wit dia parents.

  18. Nigeria northern leaders and traditional rulers call for state police

    Nigeria northern govnors and all di traditional rulers for di region, don call for di amendment of di 1999 Constitution to give legal backing to state police.

    Di recommendation dey come afta at di end meeting of Northern Govnors Forum and Northern Traditional Rulers Council, wey dem do on Monday night for Abuja.

    Inside communique wey dem release, di northern leaders say na di only way to tackle all di plenty security challenges wey dey affect di region.

    Northern Nigeria dey suffer serious insecurity challenge including banditry, insurgency, kidnapping and oda forms of criminalities.

    Dis meeting dey significant as na di first time wey di northern govnors, dey sit togeda wit traditional leaders for di region.

    For some years now, govnors, politicians and traditional leaders for from di south bin don dey call for state police.

  19. Mozambique goment arrest 29 youths for militancy

    Mozambique police don arrest 29 youths wey allegedly travel go join di militants wey dey operate for di gas-rich northern Cabo Delgado province.

    Authorities say di arrested youths wey mostly come from districts of Memba and Nacala-Porto for Nampula province, say dem move go Cabo Delgado to engage in fishing activities.

    Nampula police tok tok pesin Zacarias Nacute criticise di young pipo wey im say dem dupe wit promise of work.

    Im say dem go hand dem over to di public prosecutor office further action.

    Mozambique don dey battle Islamist insurgency for north of di kontri since 2017.

  20. Gavi don sign new Barcelona contract until 2026 wit 1bn euros release clause

    Spain midfielder Gavi don sign new contract wit Barcelona until 2026, wit 1bn euros release clause.

    Na since 2015 di 18-year-old don play for Barcelona and im dey under contract until 2023.

    Gavi make im first first-team debut for August 2021, at age 17 years and 24 days, to become di fourth-youngest player for di club history.

    Di midfielder don start all Barcelona La Liga matches dis season.