Reports of vote buying comot for Ifelodun, Olorunda area

More reports of vote buying continue to dey emerge from di govnorship election for Osun state.
Our tori pesin report say for Olorunda ward 8 unit 21, pipo dey codedly pay voters amount wey range from 5000 naira to 10,000 naira.
Our reporter see as voters dey approach two men wit "cross bag" and dey tell am say "we don finish" make dem settle dem.
One party agent wey no wan im name to dey mentioned say, "di vote buying don dey go on since morning."
"If you look dem well, you go see how dem dey share di money. I just dey look dem". E tok..
One female voter for ward 4 polling unit 3, di voter for Ikirun, Ifelodun local goment say, "dem approach me but I no gree cellect di money becos I no wan sell am"
Meanwhile, INEC official don dey ready to conclude voting for some units.
Di election dey largely peaceful and smooth for Boripe, Olorunda, Osogbo, Ifelodun and Irepodun local goment areas of di state.
Security dey on guard as voters cast dia ballots.
Many voters twale INEC for beta job while odas lament slow voting process for some parts of di state.
Accreditation and voting proper start on time for all di polling units wey BBC Pidgin carry waka enta.
Di Bimodal Verification Systems BVAs too no disappoint for all di places wey we enta.
"Di only tin wit di BVAs be say we gats try am multiple times for pipo wey dia foto no dey show well-well, but e dey work well-well". One corper tell BBC Pidgin.

































