Police don come out to show dia strength for wetin dem call 'Show of force' ahead of di Ekiti state governorship election tomorrow Saturday.
'Show of force' na part of police routine to remind pipo wey get plan to cause kasala for di election to change dia mind.
Na Deputy Inspector General of Police, DIG Johnson Kokumo dey oversee di election.
Di police patrol happun for Ado-Ekiti, di Ekiti state capital and oda neighbouring towns for di state.
Remember say di Inspector-General of Police, Usman Alkali bin announce di deployment of 31 senior officers go Ekiti for di election - dis na besides di thousands of police personnel dem deploy for di election.
On Thursday, DIG Kokumo say di number of officers and personnel no be to make pipo fear but to give dem confidence to come out come vote.
E also say sojas go dey for borders of communities "to prevent any form of intruders and we go withdraw all policemen wey attached to VIP go return to base."