You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Ekiti govnorship election 2022 as e happun

Residents of Ekiti state vote for who go govern dem for di next four years.

Live Coverage

Helen Oyibo and Victor Ezeama

  1. We don come!

    Una welcome back to our live coverage of di Ekiti state govnorship election.

    Di govnorship election for Ekiti state hold on 18 June, 2022.

    Na 16 candidates contest for di state top seat

    Before we march break, vote sorting and counting bin don happun for polling units and wetin remain na for Inec to begin announce di results local goment by local goment.

    Inec don ready now to begin.

    Stay wit us here as we follow Inec dey bring una di results as dem dey announce am.

  2. We dey come...

    We go march break for here for now on our live coverage of di Ekiti election.

    Voting begin officially by 8:30am and end by 2:30pm.

    Vote counting and sorting don take place for polling units, next go be collation and finally di declaration of result by Inec.

    We go come back to bring una live updates wen Inec begin declare di result dem.

    For now, scroll down to catch up on our updates from di election to see how e waka.

    We dey come!

  3. SDP win for one of Ekiti largest polling units

    SDP win for one of di largest polling unit for Ekiti state.

    Voting end for ward 11 Irona polling unit 013 for Olaoluwa primary school around 3:35pm. Dis na sake of di large number of voters wey turn out for election.

    Security deployment for di polling station also dey sake of crowd.

    See di break down of wetin Inec count for di Polling Unit 013 - Ward 13 Irona.

    APC - 220

    PDP - 60

    SDP - 367

  4. How di winner go emerge?

    Di Independent National Electoral Commission, INEC na di umpire - referee for di process and na dem go declare di winner of di Ekiti state govnorship election.

    According to Inec, candidate for a contested election to di office of govnor go dey declared winner if e get:

    • Di highest number of votes cast for di election; and
    • Not less dan one-quarter of all di votes cast in each of at least two-thirds of all di LGAs for di state.
  5. Vote counting from one of di largest poling units for Ado Ekiti

    Watch how dem count votes for one of di largest polling units for Ado Ekiti, Irona unit 3 ward 11.

  6. Wetin next?

    Collation and declaration of results na di next step afta voting end and na dem be critical stages for di election process.

    Collation na di process of putting togeda di votes dem cast for di election, to tabulate am and sum am up.

    While di final step for di election process na di announcement and declaration of results. Na electoral officials, Inec dey do dis one.

    Na different levels of collation dey.

    • Di Presiding Officers go send results of poll to di Registration Area/Ward level Collation Officer;
    • RA Collation Officer go collate and send result to LGA Collation Officer;
    • LGA Collation Officer go collate results and send to State Returning Officer;
    • State Returning Officer go come collate results from LGA Collation Centres and declare di result and return di winner as Govnor elect for di State.
  7. APC win for PU 003 - Ward 11 for Irona , Ado-Ekiti

    For polling unit 003 for ward 11 of Irona, dem declare di result by 3:00pm afta sorting and counting.

    PU 003 - Ward 11 Irona

    APC - 99

    PDP - 42

    SDP - 57

    Oda polling units don also begin come out across di state.

  8. Nigerians react to report of vote buying for Ekiti election

    Nigerians on social media don condemn alleged vote buying for Ekiti State wia govnorship election dey go on.

    One of di pipo wey chook mouth for di mata na di former senator representing Kaduna Central, Shehu Sani wey say di report of vote buying for di state dey unfortunate.

    Meanwhile, oda Nigerians too tok for di mata.

  9. Fotos of how di vote sorting and counting dey happun

    Vote sorting and counting dey go on polls close officially for di Ekiti governorship election.

    See some fotos from how e dey happun.

  10. Vote counting don start

    Vote counting don start for some polling stations across Ekiti state afta election officially end.

    Watch how dem count di votes for Irona unit 3 ward 11.

    Some voters bin remain behind to monitor di vote counting process.

  11. Breaking, Voting don officially end for Ekiti govnorship election

    Voting don officially end for Ekiti govnorship election.

    According to Inec, di process wey start by 8:30am go end by 2:30pm.

    But anybody wey dey queue by 2:30pm wey never vote go still dey allowed to do im accreditation and vote.

  12. Voting end early for some units

    Election don end for some polling units for di ongoing governorship election for Ekiti state.

    For polling unit 39 ward 7 Ado-Ekiti voting end as early as 10:30am.

    Di Inec adhoc staff dem tell BBC Pidgin say dem go begin sort and count di votes from 2:30pm according Inec guideine.

    Na di same situation for Ikere and Irepodun-Ifelodun Local goment areas wia some polling units conclude election early.

  13. EFCC arrest some pipo wey involve for alleged vote buying

    Nigeria corruption police di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC don arrest some pipo dem accuse of vote buying for di Ekiti Govnorship election.

    Some voters bin don complain of vote buying wey dey go on wey make EFCC officials storm some polling units.

  14. No report of attack so far for Ekiti Decides - Police

    Di Nigerian police force say di governorship election for Ekiti state wey dey peaceful so far go remain like dat till di election finish.

    Deputy Inspector General of Police, DIG Johnson Kokumo wey dey in charge of di election tok wen e address tori pipo for Mobil roundabout for Ajilosun area of Ado-Ekiti.

    Oga Kokumo lead oda Head of security on patrol to polling stations across di state.

    E say "we neva get report of any incident from any part of di state. Our men dey everi wia and dem neva radio us about any attack."

    On cases of vote buying wey don go viral for di election, DIG Kokumo also say police neva get report of vote buying, "make anybody wey get information give us becos we dey interested." E tok.

  15. APC candidate earlier on as e bin cast im vote for im polling unit

    APC candidate Biodun Oyebanji as e bin cast im vote for im polling unit for Unit 3, Ward 6 Okelele Ikogosi.

    E tell tori pipo afta e vote say di process dey peaceful and credible for im home town.

  16. Watch: DIG visit polling unit to check how di election dey go

    Di moment Police DIG Johnson Kokumo and oda security heads go monitor voting for one polling unit for Ekiti.

    Watch am for di Facebook link below.

  17. Vote buying, Bvas, change of polling stations - How Ekiti election dey happun so far

      • Author, Victor Ezeama
      • Role, BBC Pidgin

    Apart from di massive tori of vote buying across many polling units for di state, di Ekiti governorship election don remain largely peaceful.

    Election monitoring by BBC Pidgin show say adhoc staff of di Independent National Electoral Commission (Inec) come out to dia polling units early to set up.

    Di adhoc staff wey be mostly youth corps members arrive dia polling units for Ado-Ekiti as early as 7:15am.

    Voters also come out early to check dia names for di list wey Inec publish.

    Also, di Bimodal Voter Accreditation System (Bvas) wey Inec introduce last year don also work well for most part of di capital.

    Bvas na electronic device Inec design to read Permanent Voter Cards (PVCs) and authenticate voters – using di voters’ fingerprints – to prove say dem dey eligible to vote for one particular polling unit.

    Unlike wen Inec first introduce am for di 18 November 2022 governorship election wey record several challenges, di machine don work well for Ekiti.

    To use di Bvas machine na for di Inec official to scan di barcode/QR code on di PVC or Voter’s register or entering di last six digits of di Voter Identity Number or to even type di last name of di voter by di Assistant Presiding Officer (APO 1) to verify and authenticate di voter.

    Oda issues wey don come out of di governorship election for Ekiti na di creation of new polling units wey Inec do.

    Dis one make many many voters no know wia dia polling units dey .

  18. EFCC make arrest for alleged ‘See and Buy’ inside Ekiti election

  19. More fotos from di election wey dey happun for Ekiti state

    See more fotos from Irona unit 13 ward 011 Ado Ekiti, wia residents of Ekiti state dey vote for dia next govnor.

    Inec say voting go end officially by 2:30pm.

    So far, everytin dey calm and peaceful.

  20. Ekiti govnor Fayemi, wife cast dia vote without challenge

    Ekiti state Govnor Kayode Fayemi don cast im vote for di ongoing election for di state.

    Oga Fayemi cast im vote for im polling unit for Ward 11, Isan-Ekiti. Im wife also cast her vote without any challenge.

    "I call on all eligible voters to come out to perform dia civic duty and exercise dia right to choose dia leadership," e tok afta casting di vote.

    E add say, "I urge all of us to remain vigilant and to accord di security agencies and oda relevant authorities our full cooperation. Di price of liberty dey eternal vigilance."

    Govnor Fayemi go handover to whoever win dis election wey dey happun smoothly so far.