Laycon, Dorathy, Nengi, Neo and Vee go know dia fate today for di final of Big Brother Naija lockdown house.
Live Coverage
Helen Oyibo and Princess Igho Williams
Breaking, Vee don leave di Big Brother Niaja house
Wia dis foto come from, Big Brother Naija
Na end of di road for Vee as she lave di Big Brother Naija house afta 10 weeks wey she don dey dia.
She leave afta Biggie celebrate her as pesin wey dey vocal and always say her mind for di house.
Victoria Adeyele wey be 23 years old na musician wey base for Lagos, Nigeria. Dem born and raise her for London and she move come Lagos almost one year ago to begin her music career.
Fire Performance from Fireboy
Wia dis foto come from, Big Brother
One of Nigeria hottest musician, fireboy don trill fans of Big brother show with im live performance.
Di artist sing one of im popular songs 'Party scata' for di finale of di show.
Evicted housemates don show to crown di winner
Evicted housemates of di BBNaija lockdown season 5 don start pre-party before di show go begin.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 4
Wetin di BBNaija Season 5 winner go collect?
Wia dis foto come from, BBNaija
In a mata of hours, Big Brother go announce di winner of di 2020, BBNaija lockdown season 5 winner.
One of di female finalist for di Big brother Naija season 5 lockdown house, Vee say she really enjoy her all di ups and downs wey happun during di show.
Vee tell Biggie dis one during her last Diary session before di reality TV show go end dis evening.
She add say her time inside Biggies House na fun, fun, fun and emotional.
"I get big plan for mysef afta today Journey"- Neo
Wia dis foto come from, Big Brother Naija
Neo of Big Brother Naija season 5 wey dey among di five finalist say say e dey so grateful to dey di house.
Di housemate add say e get big plans for imself afta today wey wen di show go end. and e go start di family first!
Dorathy say she feel loved
Wia dis foto come from, Big brother Naija
Dorathy wey dem among di female finalist for Big brother Naija season five say she feel loved.
Di housemate tok dis one as she dey do her last Diary session with Biggie before dem leave di house today.
Dorathy say she no go change any thing from her experience from di House because of di love wey she experience.
"My experience for di house don change my life"- Laycon
Wia dis foto come from, Big Brother Naija
Laycon wey dey among di last men/women standing for di Big Brother Naija Season 5 Lockdown house say im experience for di crip na life changing.
E tok dis one during im last diary room session with Biggie.
Laycon also add say im experience no be wetin e fit explain, e dey wonderful and na full of growth.
Nengi say she dey sad
Wia dis foto come from, Big brother Naija
One of di finalist of di big brother Naija season 5 Nengi say she dey sad say dis na di her last conversation with Biggie during her Diary session.
Nengi wey cry yesterday say her friend, Ozo ignore her during dia Saturday last party, add say she no regret anything wey don happun so far during her 10 weeks stay for di house.
Rema, Fireboy and odas go Perform for BBNaija Lockdown Finale
Wia dis foto come from, Instagram Rema and Fireboy
Some of di hottest names for Nigerian music industry na im go perform for today finals of di Big Brother Naija show wey don dey on for 10 weeks.
Organisers of di show, MultiChoice Nigeria, anounce say Rema and Fireboy go perform.
Odas wey go perform na ogbonge dance group, Imagneto cabemen and popular illusionist, Babs Cardin wey go display some of im famous tricks for stage today.
BBNaija housemate Kiddwaya papaTerry Waya make news sake of im son wey dey di show
One housemate wey pipo tok about too well-well na Kiddwaya.
Tori bin come out say im na billionaire pikin but hear wetin im papa get to tok about di mata.
Wetin we call dis Video, Terry Waya: Na me get Banana Island
Which time dem go call di winner?
Di Big Brother Naija season 5 reality show dey finally end today, September 27 afta about 70 days.
Dem go kick off di grand finale wit Pre-Show party by 6pm, while di show proper go start by 7pm and e go show for DSTV and GoTV.
Big Brother go announce one out of dis housemates, Laycon, Dorathy, Neo, Vee and Nengi as di winner of di N85m grand prize.
Popular young magician Babs Cadini and upcoming highlife band, The Cavemen go totori fans wit dia performance.
Erica na di only housemate wey comot di house sake of disqualification
Wia dis foto come from, BBNaija
Dis season, one housemate chop disqualification afta biggie issue her three strikes at different occasions for breaking di house rules.
Erica Nlewedim before her disqualification na one of di favourites to win di show but her journey cut shut afta she break di house rules.
Who go win BBNaija Season 5?, Laycon, Dorathy, Nengi, Vee and Neo go find out today
Article Information
Author, Faith Oshoko
Role, BBC Pidgin, Lagos
Na today dem
go announce who win di Big Brother Naija Lockdown season afta about seventy
days wey dem don dey house.
Di season
bin start with twenty housemates and dem don drop to dia last five: Laycon,
Neo, Vee, Dorathy and Nengi.
Laycon na
rapper wey im fans dey call demselves Icon. Im don chop nomination for evition
two times since dem introduce di eviction rule for di end of August. Im dey
popular for di house sake of di advice wey im dey normally give and im
involvement for di Kiddrica (Kiddwaya and Erica) and Ozone (Ozo and Nengi)
ships.
Dorathy na
anoda pesin wey many pipo tink say go be contender as pipo dey hail her fans D’Explorers as 'silent voters.' So far, her popularity comot from how she dey
relate with fellow housemates and her involvement for di Ozone and Brighto and
Wathoni ships. She bin dey up for eviction di time wey Ozo leave house.
Neo and Vee
be like package deal for di house as na dia couple tins don make dem popular for
di show. Neo also get im talent wey don help am win challenges for house and
Vee dey popular on top her bluntness for things wey happun for house like
Laycon crush on Erica.
Nengi na one
of di pipo wey don win challenge gifts most for di house and dey popular
because of her 'ship' wey no sail with Ozo and her friendship with Laycon. Nengi
don dey up twice for possible eviction.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post, 6
Meet di 2020 BBNaija lockdown housemates, ...wen dem begin di journey
Wia dis foto come from, BBNaija
Na 20 housemates bin enta biggie house dis year.
Dem name di season di 'lockdown' season sake of coronavirus pandemic wey di world bin dey battle.
In case you miss am, see di 20 housemates wey begin di journey togeda.