All di serenren from AMVCA awards as e dey happun

Dis na we live coverage of di seventh edition of di Africa Magic Viewers Choice Awards wey dey go down for Lagos, Nigeria.

Live Coverage

Moseph Ekine

  1. Best Indigenous Language Movie/TV Series - Hausa

    And di winner na...Muhammad T. Finisher

    Muhammad T. Finisher AMVCA Best Indigenous Language Movie/ TV series - Hausa

    Wia dis foto come from, Muhammad T. Finisher/Instagram

    Wetin we call dis foto, Muhammad T. Finisher AMVCA Best Indigenous Language Movie/ TV series - Hausa
  2. Best Indigenous language Movie/TV Series - Swahili

    Raveet Sippy Chadh na di winner of dis category.

  3. Best writer for Movie or TV series

    Nicole Asinugo and CJ Obasi for di movie Living in Bondage

    Nicole Asinugo AMVCA Best Writer for Movie or TV series

    Wia dis foto come from, Nicole Asinugo/INSTAGRAM

    Wetin we call dis foto, Nicole Asinugo AMVCA Best Writer for Movie or TV series
  4. Best Soundtrack (Movie or TV series)

    Larry Gaga and Flavour na dem win dis category for di movie Tene

    Chinedu Izuchukwu Okoli aka Flavour N'abania  Best Soundtrack (Movie or TV series)

    Wia dis foto come from, Flavour N'abania/INSTAGRAM

    Wetin we call dis foto, Chinedu Izuchukwu Okoli aka Flavour N'abania AMVCA Best Soundtrack (Movie or TV series)
  5. Best Documentary

    And di winner is....Beverly Naya for her documentary Skin

    Beverly Naya AMCVA Best Documentary

    Wia dis foto come from, Beverly Naya/INSTAGRAM

    Wetin we call dis foto, Beverly Naya AMCVA Best Documentary
  6. Best Cinematographer

    John Demps don collect di award for di movie Living in Bondage

  7. Sweet Boys Association

    Lawmakers for Nigeria, senators Ike Ekweremadu, Enyinnaya Abaribe, Dino Melaye and DSTV CEO John Ugbe don join as members of Sweet Boys Association?

    We go soon find out

    SWA
  8. Best lighting designer in a movie or TV series

    And di winner is...Cardoso for di movie God calling.

  9. Best Sound Editor (movie or TV series)

    And di winner of Best sound editor goes to...Christina Aragon for di movie Living in bondage

  10. Best Picture Editor

    Tosin Igho AMVCA Best Picture Editor

    Wia dis foto come from, Tosin Igho/INSTAGRAM

    Wetin we call dis foto, Tosin Igho AMVCA Best Picture Editor

    Tosin Igho and Bryan Dike dem two na im win di category for Best Picture Editor.

    Bryan Dike AMVCA Best Picture Editor

    Wia dis foto come from, Bryan Dike/INSTAGRAM

    Wetin we call dis foto, Bryan Dike AMVCA Best Picture Editor
  11. Best make up category

    Lilian Ajibola

    Lilian omozele Paul don carry di award for Best make up category for her workd for di movie God Calling.

  12. Best costume designer (Movie or TV series)

    Dimeji Ajibola na im win dis category for di movie Ratnik

    Dimeji Ajibola

    Wia dis foto come from, Dimeji Ajibola/INSTAGRAM

    Wetin we call dis foto, Dimeji Ajibola
  13. Best make up category

    Lilian omozele Paul don carry di award for Best make up category for her workd for di movie God Calling.

  14. Winner of best art director (movie or TV series)

    Dimeji Ajibola and Iwaotan Olusola Roberts na dem win dis category for dia film 'Ratnik'

  15. 'Coronavirus on di red carpet'

    Ada Afoluwake Ogunkeye
    Wetin we call dis foto, Actor, Ada Afoluwake Ogunkeye wow everybody with her coronavirus themed dress.

    Dis na night of awards but di tori of coronavirus no dey lost on our movie actors.

    As seen on di red carpet, Ada Afoluwake Ogunkeye wear dress wey be like e get face mask.

  16. Suits for comedians, tuxedo for lawmaker

    Normally na movie pipo dey sara for AMVCA, but we don site one or two comedians and even one former lawmaker for Nigeria wey turn up.

    From Basket Mouth to Funny Bone, down to Senator Dino Melaye, dis night no be only for movie stars.

    Comedian, Basket mouth
    Wetin we call dis foto, Comedian, Basket mouth
    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

    Senator Dino Melaye

    Wia dis foto come from, Dino Melaye/Instagram

    Wetin we call dis foto, Senator Dino Melaye
  17. 26 categories of awards for 26 winners

    Dis year edition of di AMVCA go see winners comot from 26 different categories of di award.

    Among di categories seven bin dey open to public voting and dem be:

    • Best Supporting Actress
    • Best Supporting Actor
    • Best short film or online video
    • Best actor in a comedy
    • Best actress in a comedy
    • Best actor in a drama
    • Best actress in a drama
    German born Ghana actress and model, Nana Akua Addo in Guarav Gupta

    Wia dis foto come from, Nana Akua Addo

    Wetin we call dis foto, German born Ghana actress and model, Nana Akua Addo in Guarav Gupta
  18. One by one dem don dey come

    As di time of di award don dey draw near, big movie stars from everi wia for Africa don dey arrive di Eko Expo Hall, Victoria Island for Lagos State, Nigeria.

    Big brother Naija ex-housemate Venita Akpofure
    Wetin we call dis foto, Big Brother Naija ex-housemate Venita Akpofure
    Big Brother Naija ex-housemate Elozonam
    Wetin we call dis foto, Big Brother Naija ex-housemate Elozonam
  19. Welcome

    Tuale for everibody wey just dey join dis BBC Pidgin live update of di 2020 edition of di Africa Magic Viewers Choice Awards wey dey go down for Lagos.

    Na for dis live update we go dey sama una di winners and losers of dis year award as e dey hot.

    Big Brother Naija 2019 first runner-up, Mike Edwards
    Wetin we call dis foto, Big Brother Naija 2019 first runner-up, Mike Edwards