Voting don end
Voting for di election of di Senate President don end.
Dem wan start to dey count.
Nigeria national lawmakers on Tuesday elect those wey go lead dem for di Senate and House of Representatives.
Helen Oyibo and Fiona Equere
Voting for di election of di Senate President don end.
Dem wan start to dey count.
Di Senator elects still dey cast dia vote for who dem want to lead dem for di next four years.
Meanwhile Nigerians don enta social media to tok dia mind even as dem dey monitor as di mata dey go.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2

End of X post, 3

End of X post, 4

End of X post, 5
Di Clerk of di Senate don nack table and na time for voting now.
All di lawmakers go come out now to vote who dem want to be di Senate President.
Di voting go happun through di open secret ballot system.
Abuja High Court bin order di clerk of di National Assembly, the Clerk of di senate and di Sergeant At Arms say make dem no follow or enforce di secret ballot system wey senate amend for 2015.
Senator Ali Ndume dey adress im colleagues afta dem nominate am as Senate President.
Im say Senate need to work well with di Executive without compromise.
Im say Nigeria get major issue with Budget, if Nigeria fit take care of all di leakages, Nigeria no go need to dey borrow-borrow to fund di Budget.
Im say e go wan work with im colleagues so dem go dey pass budget shaperly, at most three months.
Senator Yaya Abdulahi move di motion wey Senator Solomon Yayi second for Senator Ahmed Lawan to be di Senate President.
Watch di Inauguration of di Ninth National Assembly as e dey happun live.

Na only one name na im di Clerk of di Senate call from Imo State and no be di name of di former govnor Rochas Okorocha.
Di only man wey make am from Imo na Senator Onyewuchi Francis of Imo East.
INEC bin hold Okorocha certificate, im suppose represent Imo West.
INEC say di Returning Officer wey dey in Charge of di election say, im declare Okorocha winner under duress.
Even though di Federal High Court for Abuja don order di Independent National Electoral Commission to give am, im never still get am.
Although INEC for im reply to di judgement say dem go meet as soon as possible to do di needful, dem also criticise di order say dia fear na about di safety of dia staff.
Di Inauguration ceremony of di Ninth National Assembly don begin.
Clerk of di Senate Nelson Ayewoh open di floor with roll call to know di number of lawmakers wey present.
Security tight in and around di National Assembly complex as di kontri dey wait for di opening of di Ninth Assembly and di election of di new officers wey go lead dem.
Both di military, policemen, Directorate of State Service and the National Security and Civil Defence Corps to make sure say yawa no gas.
Some lawmakers don land di National Assembly for di inauguration ceremony, including some of di pipo wey dey contest to lead di Ninth Assembly.

For 2015, Ahmed Lawan and Femi Gbajabiamila na di ruling All Progressives Congress chice to lead, but oga Bukola Saraki and Yakubu Dogara win am.
APC no go wan make e repeat imsef dis time.
Dem hype dia campaigns and di party dis time around, no sidon look like for 2015.
As e be, APC endorse both Ahmed Lawan and Ovie Omo-Agege plus Femi Gbajabiamila and Idris Wase to lead di National Assembly.
Supporters of di candidates dem hold secret meetings for hotels to toast new lawmakers.
Di opposition later come out say dem go support Senator Ali Ndume for Senate President.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post

Aside di inauguration, di lawmakers go vote principal officers wey go lead dem for di next four years.
Senate Majority Leader Senator Ahmad Lawan and Senator Ali Ndume go face each oda to compete for di Senate President seat.
House Majority Leader, Femi Gbajabiamila and im Deputy Majority Leader, Idris Wase go battle two oda pipo for speaker of di house.

Wia dis foto come from, Nigeria Senate
Nigeria go do inauguration today to welcome im tear rubber lawmakers into di Ninth Assembly.
109 senators and 360 House of Reps. members from six geopolitical zones go get di power to start to dey make law to govern di kontri.
Di eight assembly finish work officially finish work on June 6 2019.
Una good morning,
welcome to our live page.