Khadijah Abdulahi Alliance for New Nigeria

Wia dis foto come from, twitter
The Peoples Debate na collabo wey BBC, TVC, BudgiT, One, EnoughIsEnough and Transition Monitoring Group join bodi organise.
Onyinye Chime
Khadijah Abdulahi Alliance for New Nigeria

Wia dis foto come from, twitter
Rabiu Ahmed Rufai of African Action Congress (AAC)

Wia dis foto come from, instagram
Now di debate wan start.
Di major issue wey di candidates go chuk mouth on topgo be economy, Infrastructure, security, education , health and governance.
You fit watch di whole debate here.
Na Enough is Enough, wey be non gomental organisation in colabo wit BBC News, TVC News, BudgiT, One, and Transition Monitoring Group join bodi organise am.
Di ogbonge moderators na BBC tori pesin Aliyu Tanko and Ngozi Alaegbu from TVC.

Debate go soon start. To watch am live make click on di live video for top of di page


Debate go start by 7:30pm for Abuja di seat of power.
Six candidates from PDP, APC, ANN, YPP, ACC and SDP go get opportunity to tell Nigerians dia plans if dem become vice president.

Wia dis foto come from, wikimedia commons
Na plenty hailing we cari come your domot dis evening as we bring una di Vice Presidential Debate for 2019 elections.
Dis debate na part of our package as we dey prep for di presidential election come February 16.