BBC Governorship Debate for Rivers State: Live updates as e happun

We don invite five candidates wey go ansa kweshion about dia policies and how dem wan take move di Rivers State forward.

Live Coverage

Olu Okunnu

  1. BBC Pidgin Team full ground

    Harry Itie, BBC Journalist post dis foto for social media to show im ginger for di debate.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  2. Victor Fingesi of Action Democratic Party
    Wetin we call dis foto, Victor Fingesi of Action Democratic Party don land
    Eniye Braide of di African Democratic Congress
    Wetin we call dis foto, Eniye Braide of di African Democratic Congress sef dey ground
  3. Guests for di BBC Pidgin Rivers State govnorship debate
    Wetin we call dis foto, Guests don dey siddon, ready demsef
    Guests for di BBC Pidgin Rivers State govnorship debate dey do registration
    Wetin we call dis foto, Guests for di BBC Pidgin Rivers State govnorship debate dey do registration now
    Di chair arrangement no be here!
    Wetin we call dis foto, Di chair arrangement no be here!
  4. We dey Live for web, video streaming, radio and television

    Hear from di BBC Pidgin Editor, Adejuwon Soyinka as im tok about di different ways wey pipo fit follow today debate so dat dem no go miss anytin.

    Im also tok about how pipo of Rivers State take tell us who and who dem want make we invite for di debate.

    Wetin we call dis Video, Rivers State pipo say na dis five pipo dem wan see for govnorship debate
  5. Join di debate ontop social media

    Use di hashtag #BBCGovDebate and #BBCPidginDebate to ask di candidates qweshion or to drop your comment.

  6. Stay wit us on dis Live page and we guarantee say you go get ogbonge updates on how di debate dey go – as e dey hot!

  7. Coverage go dey from our partner stations dem
    Wetin we call dis foto, You also fit follow di debate on oda channels from our partner stations dem
  8. Live from Port Harcourt

    Today by 10am sharp, govnorship candidates wey dey contest for Rivers State, south-south Nigeria, go share wetin dem wan do for dia pipo if dem become di next govnor.

  9. BBC Pidgin Govnorship Debate for Rivers State
    Wetin we call dis foto, Stage don set and ready for dis morning Rivers State govnorship debate, Live from Port Harcourt.
  10. Una good morning, Thank you for joining us as ground don set for di second BBC Pidgin debate for di 2019 elections

    We welcome una to di Rivers State govnorship debate wey we package as part our preparation for di 2019 elections for Nigeria.