1 min
AC Milan 0-0 Newcastle
Zlatan Ibrahimovic dey here to watch im former Milan mates.
Di AC fans dey here too, in big numbers. Atmosphere dey charged.
Among all di English teams, na Newcastle dey wetin many pipo believe say na di toughest group wit di likes of Paris St-Germain, Italian giants AC Milan and former Champions League winners Borussia Dortmund.
Tunde Ososanya and Victor Ezeama
AC Milan 0-0 Newcastle
Zlatan Ibrahimovic dey here to watch im former Milan mates.
Di AC fans dey here too, in big numbers. Atmosphere dey charged.
Evri one take moment to remember di victims of di recent tragedies for Morocco and Libya.
And den di match don begin.
Dis season competition don properly begin in a big way.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Milan chop 5-1 from Inter Milan last week Saturday and di hope be say Stefano Pioli go fit use dis game to come back stronger afta di heavy defeat wey shelle last weekend.
Na good tin for Pioli say Fikayo Tomori dey eligible to play afta im Serie A suspension.
AC Milan get plenty former Premier League players for dia squad.
Sandro Tonali of Newcastle go enta pitch to face im former club and e go dey interesting to see di kain reception wey im go receive.
Eddie Howe don call on Sean Longstaff and Jacob Murphy for dia big Champions League return.
Alexander Isak dey lead di line.
AC Milan and Newcastle neva play each oda before. Na dis match go be dia first match togeda.
Pioli side dey feature for di third season in a row, while Howe side dey play dia first UCL game in ova 20 years.

Wia dis foto come from, Getty Images
AC Milan go enta one shokoto wit Newcastle for San Siro on Tuesday as di first round of European Champions League group stage dey shelle.
Di Group F game dey happun afta AC Milan chop 5-1 from Inter Milan for di derby wey shelle for last week Saturday
Today game wit Newcastle go be about redeeming dia image sake of wetin dia eyes see on Saturday.
Stefano Pioli wey be AC Milan coach bin tok for press conference say e dey important to put di disappointment behind dem and try to use di home crowd as springboard to get back on di right path.
Pioli wey dey face Eddie Howe bin also tok for press conference say di round na tough one and add say di group dey balanced and evri point wey dem will go count.
“We know how e be to start well. Newcastle get intense, aggressive, and physical side wey also get quality,” e tok.

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Uefa Champions League go start today wit matches across Europe.
One of di matches wey eyes go dey on na di match between former Italian champions AC Milan and Newcastle from England.
Di match go see Serie A side AC Milan play Premier League club Newcastle United.
Newcastle oga Eddie Howe say e go be a "proud moment" for am wen e attend im first Champions League game and lead di Magpies against AC Milan for di San Siro Stadium.
Newcastle dey return to dis ogbonge football competition for Europe for di first time in 20 years.
Newcastle go face AC Milan side wey lose dia derby 5-1 to Inter Milan on Saturday.
Magpies midfielder Sandro Tonali go face im club wey im leave during summer for £53m.
"E go be di most thrilling feeling to come out into di stadium packed wit pipo again," di Italy international tok.
Newcastle last game for di Champions League na a 2-0 home defeat by Barcelona in March 2003.