How Man City hold Real Madrid to draw first leg of Champions League semifinal

Two heavyweight clubs meet each oda for di first leg of di Champions League Semifinal.

Live Coverage

Moseph Ekine

  1. , 40 mins

    Man City look like say dem dey shocked for wetin just happen as dia passes no come dey connect.

    Real Madrid 1-0 Man City

  2. Goal for Real Madrid!, 36 mins

    Vinicius Junior wit rocket shot from outside di box.

    Real Madrid 1-0 Man City

  3. , 34 mins

    Sweet move from di host see Valverde break free down di right.

    Di Uruguyan cross di ball towards Benzema wey mistakenly control am wit im hand.

  4. , 29 mins

    Real Madrid players no dey too happ for di ref becos im stop dia attacking move.

    Di ref decide to pause di game as Gundogan need to receive treatment afta Rudiger foul am but ref no see am.

    Di German midfielder look like im dey fit to kontinue and di play don resume.

  5. , 26 mins

    Vinicius Junior dance im way down di left wing wit real intention to find Benzema wey dey inside di area.

    Di 22-year-old try to find di Frenchman wit a cutback but Ruben Dias read di ball well as im slide am clear.

    Real Madrid 0-0 Man City

  6. , 24 mins

    Real Madrid fans want dia players to come out come play.

    Wit just under 30 mins of play, di visiting team don dominate di game so far.

    Real Madrid 0-0 Man City

  7. , 19 mins

    Man City players want freekick just outside di area as John Stones go down from wetin im believe say na genuine tackle.

    Di ref wave play on.

    Real Madrid 0-0 Man City

  8. , 16 mins

    So far Real Madrid dey level for dis game thanks to dia goalkeeper wey don save di ball well from shots by City players.

    Di shot count so far favour Man City by 5-0

    Real Madrid 0-0 Man City

  9. , 13 mins

    City test Courtois again wit shot from outside di box.

    Dis time na Rodri wey produce long range shot wey dey on target but di goalkeeper save am.

    From di cornerkick City want penalty as Haaland fall inside di box.

    Referee wave play on instead.

    Real Madrid 0-0 Man City

  10. , 8 mins

    De Bruyne! Good save by Courtois wey dive low to punch di Belgian shot wide.

    Real Madrid 0-0 Man City

  11. , 6 mins

    City dey try to press Real high as di men in white no fit find space comot from dia half.

    Camavinga later send di ball to Carvajal wey cool di press small as im send am back to Rudiger.

    Real Madrid 0-0 Man City

  12. , 3 mins

    Vinicius try to up di tempo of di match as im begin tear race wit di ball.

    Di Brazilian try to find Benzema wit a cross but di Frenchman fail to control am.

    Real Madrid 0-0 Man City

  13. , 1 min

    Kickoff

    Man City don begin di match.

    Fans for di Bernabeau dey in fine voice as dis big match don begin.

    Real Madrid 0-0 Man City

  14. , Real Madrid v Man City (20:00 GMT)

    Both teams don enta di pitch, na only few minutes remain now until kickoff.

    But first di Champions League anthem.

  15. 'City na different side from last year' - Ancelotti, Real Madrid v Man City (20:00 GMT)

    Real Madrid coach Carlo Ancelotti

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Real Madrid boss Carlo Ancelotti believe say City be "more complete team" dan dem bin be last year wen di two face each oda.

    "Dem get very good forward in di person of Gabriel Jesus, but im get different characteristics to Erling Haaland," Ancelotti add.

    "Now, City fit take more advantage of long balls, becos dem get very tall striker, and behind am na [Kevin] De Bruyne, so dem fit win balls in di air.

    "Dem neva change dia style. Dem dey very well organised at di back and dem be team wey dey handle di ball very well."

  16. 'Everitin go dey decided for Manchester', Real Madrid v Man City (20:00 GMT)

    Man City coach Pep Guardiola

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Real Madrid - wey beat Liverpool for last year final - go travel go Manchester for di second leg of dis semi-final on 17 May.

    For dia tie wit Real Madrid last year, City win 4-3 for dia home, dem come extend dia lead for di Bernabeu before Real stage late comeback.

    "Di difference dis year na di second leg at home," na so Pep Guardiola tok.

    "I no dey sure if na advantage or disadvantage but I tink everitin go dey decided in Manchester."

  17. Team news, Real Madrid v Man City (20:00 GMT)

    Both sides no really change dia lineup from wetin many expect.

    Manuel Akanji start for left-back for Manchester City. Nathan Ake go miss dis match due to calf injury.

    Erling Haaland and Kevin de Bruyne predictably dey di line-up.

    Real Madrid defender Eder Militao dey suspended, while Antonio Rudiger start di match.

    Man City XI:Ederson, Walker, Stones, Dias, Akanji, De Bruyne, Rodri, Gundogan, Silva, Grealish, Haaland.

    Real Madrid XI:Courtois, Carvajal, Rudiger, Alaba, Camavinga, Modric, Kroos; Valverde, Rodrygo, Vinicius, Benzema.

  18. Two teams wit eyes on di final prize

    Champions League trophy

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Time for di Champions League semi-finals don reach.

    Manchester City face European Kings Real Madrid while Inter Milan go take on AC Milan.

    But before di eyecatching Italian derby, today na di turn of di reigning English champions and dia counterpart from Spain.

    Welcome to BBC Pidgin live text coverage of dis huge semifinal fixture.