You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Martinelli and Guehi own goal give Arsenal victory for Premier League

Crystal Palace lose opening game to Arsenal 2-0.

Live Coverage

Moseph Ekine and Tamara Ebiwei

  1. Jesus and Zinchenko make Arsenal debut

    Gabriel Jesus and Oleksandr Zinchenko both make dia debuts for Arsenal afta dem arrive from Manchester City, while 21-year-old defender William Saliba - wey spend last season on loan for Marseille - get im first Gunners start.

    Arsenal XI:Ramsdale, White, Gabriel, Saliba, Zinchenko, Partey, Xhaka, Odegaard, Saka, Martinelli, Jesus.

  2. Cystal Palace starting lineup

    Crystal Palace fans go dey excited to see new midfielder Cheick Doucoure make im debut for di club afta im arrive from Lens dis summer.

    Fellow new signing Malcolm Ebiowei dey on di bench, while goalkeeper Sam Johnstone also dey among di substitutes.

    Crystal Palace XI: Guaita, Clyne, Guehi, Andersen, Mitchell, Doucoure, Eze, Schlupp, Ayew, Zaha, Edouard.

  3. Crystal Palace vs Arsenal injury news

    Crystal Palace midfielders Michael Olise and James McArthur no go play today match becos dem get foot and groin injuries.

    Defender James Tomkins get muscle issue, while goalkeepers Jack Butland and Sam Johnstone too go also missout.

    Arsenal midfielder Emile Smith Rowe, wey dey struggle wit groin issue fit no play too.

    Some players for Arsenal dey recover from injuries like Kieran Tierney, Takehiro Tomiyasu and Fabio Vieira. But Manager Mikel Arteta say "most of dem" go dey available for di match.

    Defender William Saliba stand for line to start im first match for Arsenal, while former Manchester City players Gabriel Jesus and Oleksandr Zinchenko fit play im first match too.

  4. Crystal Palace vs Arsenal build up

    To begin di new season, Arsenal don travel to Selhurst Park wia dem go take on Crystal Palace.

    Dis na di first match out of 10 wey go happun dis weekend. Di oda matches include:

    • Fulham vs Liverpool
    • Bournemouth vs Aston Villa
    • Leeds vs Wolves
    • Newcastle vs Nottingham
    • Tottenham vs Southampton
    • Everton vs Chelsea
    • Leicester Brentford
    • Manchester vs Utd Brighton
    • West Ham vs Manchester City
  5. Wetin happun last season?

    Last season, we get di usual ups and downs as di Premier League season close. Man City bin celebrate, Liverpool lose di chase to win di league and Burnley chop relegation.

    Arsenal end tins on bittersweet note, dem waya Everton 5-1 to end di season of so many positives but one wey also see dem miss out to north London rivals Tottenham in di race for Champions League football.

  6. Welcome!

    Afta 75 days of wait, di Premier League don come back!

    Hello and welcome to BBC Pidgin live-text coverage of di new season.