, Crystal Palace to 'keep pushing'
Crystal Palace say dem go kontinue to push for di match even though dem dey behind.
Plenti time still dey to play for afta di break.
You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Crystal Palace lose opening game to Arsenal 2-0.
Moseph Ekine and Tamara Ebiwei
Crystal Palace say dem go kontinue to push for di match even though dem dey behind.
Plenti time still dey to play for afta di break.
Arsenal dey filled wit excitement as dem take di lead before di break.
Dem go need kontinu to push even though dem dey lead at di moment.
You go dey encouraged by dat first half if you be Arsenal fan. Dem look good on di ball and on di break, Gabriel Jesus dey show why di hype follow am from pre-season.
Palace don repeatedly try to get Wilfried Zaha into di game but Arsenal defender Ben White don mark am well so far.
Crystal Palace 0-1 Arsenal
Just before referee blow di whistle for half time, Crystal Palace striker Edouard shoot dangerous shot wey Xhaka block go out for corner kick.
Arsenla don get di better chances for dis half but di match still boku.
Crystal Palace 0-1 Arsenal
Yellow card for Arsenal midfielder Granit Xhaka.
Di former Gunners captain collect booking for diving.
Crystal Palace don begin dey dictate play here.
Di hosts test Arsenal goalkeeper through Edouard header.
Ramsdale produce good strong hand to deny di Frenchman from equalising for Palace.
Crystal Palace 0-1 Arsenal
Seven more minutes before half time and Palace don win freekick inside Arsenal half.
Referee blow im whistle say Partey foul Zaha.
Crystal Palace 0-1 Arsenal
Good defending from Bukayo Saka.
Di Arsenal winger track back and get himself between man and ball as Wilfried Zaha look to buy a yard to curl in im shot.
Arsenal dey on di up since dem take di lead.
Di Gunners pressure Palace defence into conceding Corner kick.
Goalkeeper Guita punch Martinelli cross clear.
20 mins
Arsenal don take di lead through Gabriel Martinelli.
Crystal Palace 0-1 Arsenal
Referee Anthony Taylor don stop play afta Ayew togeda wit Doucoure combine to foul Martinelli.
Wilfred Zaha try to dribble im way into di Arsenal box.
Im cross hit Xhaka for face, referee don stop di match temporarily to check if di Swiss dey okay.
Xhaka dey alright and di match don kontinu.
8mins
Crystal Palace 0-0 Arsenal
Arsenal dey look slcik on di ball for di opening minutes as dem dey open Palace defence but nothing don come out of dia interesting play so far.
4 mins
Crystal Palace 0-0 Arsenal
Gabriel Martinelli miss good chance to open di scoring for Arsenal.
Jesus dribble past some defenders but Geuhi block im shot wey come see di ball land in front of Arsenal new number 11.
Di 21-year-old Martinelli come jab di ball go wide of di post.
Both teams don come out on di Selhurst Park pitch wit cheers by di fans.
Crystal Palace wear dia home kit of red and blue while Arsenal dey in dia away jersey colours.
And di match don start. Eberechi Eze take di first kcik of di season.
Football fans don begin predict how di match go end.
Some say home team Crystal Palace go win, some say Arsenal wey be visitors go win.
Anoda group say na draw e go end.
You sef fit send us your own prediction by tweeting at us for @bbcnewspidgin.
Arsenal don lose dia opening Premier League matches five times out of di last nine seasons (W4), including 2-0 defeat to Brentford last season.
Dis na di third back to back to back season wey Arsenal start Premier League campaign wit a London derby.
Mikel Arteta side don fail to keep clean sheet for all of dia last 10 league matches. Bukayo Saka be di top league scorer last season wit 11 goals – and na di joint-lowest total by an Arsenal player for di Premier League since Robin van Persie wey also scored 11 goals for 2006-07 and 2008-09 seasons.
Gabriel Jesus score six goals wit one assist for im final seven league games for Manchester City.
Crystal Palace Crystal Palace don win dia opening league match for five of dia previous 22 top-flight campaigns (D7, L10).
Dem don also win two of dia last four season curtain-raisers (D1, L1).
Di Eagles lose only four of dia 19 Premier League home matches last season (W7, D8).
Dem end last season unbeaten for six games for Selhurst Park.
Crystal Palace also win three out of di six matches.
Manager Patrick Vieira side neva concede any goal for dia last five home matches, as dem equal a club record set between March and April 1992.
Crystal Palace don lose one of dia past eight Premier League meetings wit Arsenal (W2, D5).
Di Eagles dey target to win back to back League games against di Gunners for di first time afta dia 3-0 home victory for April.
Di win wey dem get over Arsenal last season na dia joint-biggest home win of di campaign, dem also beat Tottenham and Norwich by di same scoreline.