Ghana vs Nigeria - How e happun live for Kumasi

Ghana dey play dia fellow West Africa neighbours Nigeria for di Baba Yara Stadium for Kumasi.

Live Coverage

Helen Oyibo and Victor Ezeama

  1. 10 minutes inside 2nd half, no goal

    Di tempo of di game don drop go average. Di two teams don begin play jam bodi.

  2. Partey dey in control of midfield

    Arsenal midfieflder Thomas Partey dey run tins for di midfield. E dey control di ball well.

    Nigeria neva settle down since di second half start.

  3. Ghana dey in control of di ball

    Ghana don get back to back corner from di immediate pressing. Coach Addo dey tell im boys to throw long balls inside Super eagles half.

  4. Second half don start

    Second half start wit sharp press from Ghana.

    Black stars use di same energy wey dem use start di first half, start di second half.

  5. Breaking, Half Time

    Di centre refree don end di first 45 minutes of dis high intensity game.

  6. Two minutes added time

    Referee go soon end di first half of dis match make coaches go re-strategise

  7. William Troost-Ekong

    Eagles defender Troost-Ekong nod ball comot afta threat from AS Roma forward Gyang

  8. Final five minutes

    We don enta di final five minutes of di game.

  9. Be like Super eagles don dey enta di game

    Di game don dey come alive. Ghana don drop possession and Nigeria don begin take advantage as Ghana dey withdraw.

  10. Daniel Amartey still dey worry Osimhen

    Daniel Amartey block anoda ogbonge shot from Victor Osimhen.

  11. Super eagles no dey fit control ball

    Nigeria dey try to get possession of di ball but dem no get ball control. Amartey dey hold di Ghana defence tight.

  12. Uzoho make anoda save

    Na reflex Uzoho take save di shot

  13. Teams take water break

    We don already see over 30 minutes of dis game. We still dey wait for di first goal of di game.

  14. Coaches clearly dey under pressure

    Ghana coach Addo and Eguavoen of Nigeria neva fit siddon for one place since di game start.

  15. Uzoho make anoda save

    Nigeria goalkeeper Uzoho clear ball afta quality shot from Mensah from di left side.

  16. Super eagles no fit give through pass

    Ghana don try to stop passes to Nigeria striker, Osimhen. Daniel Amartey gum Osimheh like glue. E no dey allow pass reach am

  17. Ghana clear Super eagles danger from dia defence

    Osimhen no get di right control for di ball afta Zaidu Sanusi outrun di Ghanaian wing back. Ghana Amartey clear Osimhen cross

  18. Ghana dey control ball

    Ghana dey control di ball well. Dem dey in control and Thomas Partey dey dictate play for midfield.

  19. Ghana dey play 5 man defence

    Na serious action dey happun inside di Baba yara stadium.

    Balogun just make beta stop afta Moses SImon lose possession.

  20. Super eagles dey press

    Di match don start wit plenty intensity, at di moment Nigeria get more ball possession