10 minutes inside 2nd half, no goal
Di tempo of di game don drop go average. Di two teams don begin play jam bodi.
You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Ghana dey play dia fellow West Africa neighbours Nigeria for di Baba Yara Stadium for Kumasi.
Helen Oyibo and Victor Ezeama
Di tempo of di game don drop go average. Di two teams don begin play jam bodi.
Arsenal midfieflder Thomas Partey dey run tins for di midfield. E dey control di ball well.
Nigeria neva settle down since di second half start.
Ghana don get back to back corner from di immediate pressing. Coach Addo dey tell im boys to throw long balls inside Super eagles half.
Second half start wit sharp press from Ghana.
Black stars use di same energy wey dem use start di first half, start di second half.
Di centre refree don end di first 45 minutes of dis high intensity game.
Referee go soon end di first half of dis match make coaches go re-strategise
Eagles defender Troost-Ekong nod ball comot afta threat from AS Roma forward Gyang
We don enta di final five minutes of di game.
Di game don dey come alive. Ghana don drop possession and Nigeria don begin take advantage as Ghana dey withdraw.
Daniel Amartey block anoda ogbonge shot from Victor Osimhen.
Nigeria dey try to get possession of di ball but dem no get ball control. Amartey dey hold di Ghana defence tight.
Na reflex Uzoho take save di shot
We don already see over 30 minutes of dis game. We still dey wait for di first goal of di game.
Ghana coach Addo and Eguavoen of Nigeria neva fit siddon for one place since di game start.
Nigeria goalkeeper Uzoho clear ball afta quality shot from Mensah from di left side.
Ghana don try to stop passes to Nigeria striker, Osimhen. Daniel Amartey gum Osimheh like glue. E no dey allow pass reach am
Osimhen no get di right control for di ball afta Zaidu Sanusi outrun di Ghanaian wing back. Ghana Amartey clear Osimhen cross
Ghana dey control di ball well. Dem dey in control and Thomas Partey dey dictate play for midfield.
Na serious action dey happun inside di Baba yara stadium.
Balogun just make beta stop afta Moses SImon lose possession.
Di match don start wit plenty intensity, at di moment Nigeria get more ball possession