E dey hard to look
past holders Algeria, wey dey on a 34-match unbeaten run and wey Manchester
City winger Riyad Mahrez dey lead.
Sadio Mane Senegal,
Africa top-ranked side for di past three years, be runners-up for 2019 and
among di main challengers, while record seven-time champions Egypt get di best
player for di world right now in Mohamed Salah according to some – Salah dey shine
for Liverpool dis season.
Ghana and Nigeria dey among
di continent most successful kontries but dia 2022 World Cup qualification
campaigns no too bam, while Cameroon – dey pursue dia sixth Nations Cup title.
Mali fit be surprise
package afta dem reach di World Cup play-offs by going unbeaten despite home
advantage.
Ivory Coast, Morocco
and Tunisia dey among di oda former champions present and, for di oda end,
Comoros and The Gambia be first-time qualifiers.