France don win World Cup

France win dia second World Cup for history, as dem nack Croatia for match wey get plenti action, including pipo wey run enta field.

Live Coverage

Busayo Iruemiobe

  1. HALF-TIME, France 2-1 Croatia

    What a wawu!! Dis match no easy for any of di teams. Dem don enta dressing room to go drink water.

  2. , Still on dat penarity

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  3. , France 1-1 Croatia

    Some pipo feel say e no suppose be pena.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  4. GOAL, France 2-1 Croatia

    Antoine Griezmann send Subasic go one side to score for Les Bleus.

    Griezmann score penarity

    Wia dis foto come from, Getty Images

  5. PENALTY, France 1-1 Croatia

    VAR don give penarity against Croatia.

  6. Video Assistant Referee, France 1-1 Croatia

    E don tey we see am for di World Cup, but e don appear again.

  7. , France 1-1 Croatia

    Ivan Perisic shot eh, no be here. E be like say im vex wan tear di net. Game on!

  8. GOAL, France 1-1 Croatia

    Ivan Perisic don equalize.

  9. Mandzukic own goal, France 1-0 Croatia

    Di replay show say no be Varane head di ball hit, but na own goal from Croatia striker Mario Mandzukic.

  10. GOAL, France 1-0 Croatia

    Mario Mandzukic head ball enta im own net.

    Na Antoine Griezman cross sweet ball enta inside di box and e look like say na France defender Varane head am. But no, na own goal from Mandzukic.

    Mandzukic header

    Wia dis foto come from, Getty Images

  11. 17mins, France 0-Croatia

    France don dey see ball play small, and e be like dia plan na to dey give Giroud for head.

  12. , Croatia don hold ball pass and dem dey play inside France area.

    Map heat

    Wia dis foto come from, Opta

  13. Croatia dey press France

    Di action now dey happun inside di French half as Croatia no wan allow dem see road comot. Dem don even win di first corner of di match.

  14. , France 0-Croatia

    Na Croatia don see ball pass so far, but notin don really happun.

  15. KICK-OFF

    Na Croatia pass di first ball for di 2018 Fifa World Cup final.

  16. Dem don sing anthem finish, shake hand finish. Now, na time for action.

  17. Umtiti dey get plenti support from Cameroon

    Cameroon born French defender Samuel Umtiti dey get plenti support from im pipo. BBC Pidgin waka enta di village wey im from and yan wit im anti and uncle.Link

  18. How di teams go line-up, Nothing don change for di two teams, as dem select di same teams wey win for semi-finals.

    Teamsheet

    Wia dis foto come from, Fifa

  19. E don set! Welcome to di main di main baba for football ⚽⚽⚽