How day one of End bad governance protest waka across Nigeria
Summary
Kano state government partially relax curfew to allow for prayers
Day two of di protests dey on across states of di federation
Di protests na against wetin dem describe as hunger and bad governance
For Abuja, Nyesom Wike wey be di Minister of di Federal Capital Territory say make demonstrators limit dia activities to di Moshood Abiola Stadium
Lagos, Rivers, Oyo, and some oda places dey peaceful for day two of di protest
Live Coverage
Tunde Ososanya, Annette Arotiba, Helen Oyibo and Kareemot Salami
Nigeria Bar Association set up free legal services for protesters
Nigerian
Bar Association (NBA) say dem don establish Legal Support Services Teams across di
kontri to offer free legal services give protesters wey dia fundamental rights fit
dey breached during di nationwide protests wey start for Nigeria on Thursday morning.
NBA
President, Yakubu Maikyau (SAN) for one statement on dia X account direct
all di chairpesins of di 130 branches of di association to ensure say dia
respective human rights committees take up observed or reported cases of breach
of fundamental right(s) of any citizen, harassment, intimidation or torture wey
law enforcement agents carry out during di course of di protest.
Oga Maikyau add say make di Chairpesins set up situation
monitoring committees to monitor and report activities and interactions between
law enforcement agents and di protesters.
Online monitoring form dey to fill for anybody wey im rights dey
breached, e tok.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
Fire burn NCC digital hub
Dem don set di Industrial Digital Park of di Nigerian Communications Commission (NCC) for Kano on fire.
Di Park na one of di creative hubs of di Commission.
Video wey one Nigerian lawyer Abba Hikima share on im Facebook page show as small pikin dem storm di building to destroy am.
Three injure afta police fire live bullets at protesters for Kano
Three protesters don injure for Kano afta police fire live
bullets at protesters wey dey march to di State Goment House.
Di protest start on Thursday morning, as angry youths for di state gada to demand for end to wetin dem describe as bad governance.
Police fire live bullet to scata di protester wey dey march
go Kano State Goment House to meet wit goment officials.
Earlier, dis morning police officers also fire teargas at di protesters.
One of di protesters wey follow BBC tok say di situation don
tire dem as hunger dey di kontri,
E tok say pipo no need di infrastructure wey goment dey
build as hunger dey catch dem.
“Di situation don tire us, we no dey afraid, we no dey
afraid of security forces. We no fit tolerate am anymore. You fit arrest us. We
don tire, we dey hungry. We dey hungry but dem dey build bridges. We no need
bridges wen pipo dey die,” e tok.
Enugu City empty as pipo no protest
Nobodi come out for Enugu City to protest as di streets dey empty.
Dis na some of di fotos of di empty streets of Enugu City:
Most govnors across Nigeria 36 states don
react to di #EndBadGovernance protest wey dey go on across di kontri.
Ahead of di protest, some state govnors bin tear warning give dia pipo say make dem no
follow join di protest, odas call for patience, say make dia pipo dey patient wit
di current administration as tins go still beta.
One of dem na di Lagos State Govnor Babajide Sanwo-Olu, wey say di state no go allow
wetin happun for 2020 #EndSars protest wia youths enta street to call for di disbandment of di Special anti-robbery squad police unit, reoccur again for di state.
E say di protest bin start on peaceful note bifor jaguda pipo hijack am wey lead to destruction of property and looting.
Di govnor say protest no go bring di progress di
kontri need now and e no go make di challenges wey di kontri dey face disappear
in 10 days. E no go lower di prices of food or bring about economic growth
instead e go scata di progress wey di goment don make.
E tok of di new minimum wage bill di president pass
into law, di student loans plus wetin im don do for di state to stabilise di
economy and assure say “we go do more and we will”.
Also di Rivers State Govnor Sir Siminalayi Fubara bin
tok say credible informate dey ground say some mercenaries and thugs don
hire pipo from outside, under di guise of protest, to destroy valuable
infrastructure assets for di state.
Fubara say true-true Nigerians dey face economic hardship
but add say di federal government, under President Bola Tinubu dey take
believable actions to address di current hardship and secure beta future for di
pipo.
Imo State Govnor Hope Uzodinma also say make pipo no protest as
jaguda pipo fit hijack am and e fit lead to serious kasala.
E say make kontri popo dey patient and trust goment plans as e add say dem don start plenty interventions and programmes wey dey aimed at providing
immediate relief.
Edo State Govnor Godwin Obaseki tok say im stand
wit Nigerians ova di hardship and difficulties dem gatz endure particularly ova
di last one year, wey e say come from various policies wey di Nigerian goment
implement.
However, e appeal to di organisers of di protest to
consider oda forms of protest instead of demonstration on di streets.
E assure dem say di state goment don mobilise
security agencies to dey on high alert and provide protection for genuine
protesters.
Oda govnors also ask citizens to exercise patience
as Tinubu goment don initiate economic reforms wey go yield beta fruits for di
kontri.
Fotos from across di kontri as EndBadGovernanceinNIgeria protest dey go on
#EndBadGovernanceinNigeria protesters demonstrate across di kontri
Nigerians across di kontri dey hold demonstrations to push back against economic hardship, rise of inflation, devaluation of naira, increase of electricity and removal of subsidy.
For Lagos, protesters dey march for Ikeja wia dem dey chant ‘Ole’, ‘We no go gree’ and ‘End bad goment’ while dem carry placards wit inscription ‘Hunger dey too much’.
Di protesters dey march to Ojota park wia dem wan gada dis Thursday morning for di August protest wey dem tag ‘EndBadGovernanceInNigeria.’
Some pro-goment protesters also don gada for Alausa, Ikeja as dem carry placards wit inscriptions ‘let us dialogue, no burn our city’
However, Heavily armed police officers currently dey for Ojota gearing to monitor di EndBadGovernanceInNigeria protest.
For Port Harcourt, protesters gada for Pleasure park for di protest.
Di protesters dey chant.”Solidarity is forever’ as dem dey march go federal secretariat complex
Police officers also dey on ground to monitor di protest for di state.
Lagosians carry protest enta streets
Wetin we call dis foto, Protesters for Lagos storm di street
Protesters don storm streets of Lagos state to march against wetin dem call #EndBadGovernace.
Dis na sake of di economic situations for Nigeria.
'End bad governance' protesters reveal plans for August 1
Why Nigerians wan protest on August 1?
Di protesters dey march from Ikeja go Ojota wia dem dey chant songs and different names to show dia pains.
Di police dey monitor di situations as e dey go and dey try control di crowd.
Protest to stop protest?
As some Nigerians enta
street to protest against di rising cost of living and economic hardship, for
Alausa inside di capital of Lagos state, some pro-govment protesters too don come out to kick against di protest and show
support for di goment.
Di pro-goment posters carry
placards wey dem write “Say No To Violent Protest, Let Us Dialogue Don’t Burn
Our Cities, Why 10 Days Street Protest, Probe Economic Saboteurs," among odas.
While di ones wey dey
in support of di protest dey for one side of di road wit dia placards to end
bad governance.
Many of di roads
wey lead to Ikeja dey blocked as plenti security officers mount different
angles wit ammunitions.
Police stand for Ojota to wait for protesters
Wetin we call dis foto, Police officers dey wait protesters
As early as 8:30am, police officers bin gada for Ojota wia di #EndBadGovernance protest suppose begin dey hold.
Dressed in dia black and white uniforms, di police dey armed wit dia ammunitions.
Plenty of di protesters neva show face as at dis time as di road dey silent and plenty motor no dey waka for road.
Police block different entrance wey protesters fit pass enta Ojota directly.
Fed up wit hunger, Nigerians begin protest against hardship
Nigerians begin di nationwide protest against hunger and hardship for di kontri.
Di protest currently dey go on for Lagos, Abuja, Port Harcourt and oda parts of di kontri, despite calls from di presidency, security agencies, traditional rulers and odas say make pipo no protest.
Na young Nigerians dey champion dis protests wey don dey build up for several weeks now.
Out of a population of ova 220
million, about 161 million pipo for Nigeria dey face food insecurity, while
39.4 million pipo dey under undernourished, according to di 2024 report on
‘State of food security and nutrition for di world’.
#EndBadGovernanceinNigeria na one
of di hashtags dem dey use to ginger pipo for di protests. E show di feelings
of some Nigerians wey say dem dey face serious economic hardship under
President Bola Tinubu.
As di economy dey shake, and di rising cost of
living dey make daily survival harder for millions of Nigerians and many feel say
di kontri leaders continue to live extravagantly and add say di present
national cabinet na di largest in history.
Authorities beef up security across di kontri
Authorities don beef up security across di kontri to secure
lives and property as di protest dey go on.
Bifor now di advice to Nigerians be say make dem shelve di
protest sake of say some pipo fit hijack am to cause violence.
Nigeria Inspector General of Police (IGP) Kayode Egbetokun also
advise say make di organisers of di protest do am for confined spaces across di
kontri but dem reject di proposal.
“E no good make una do street procession becos as una dey plan
protest, some pipo dey plan violence,” IGP bin tok wen e meet wit some of di
protest organisers.
But Ebun-Olu Adegboruwa (SAN), one lawyer for Take It Back
Movement, one of di groups wey dey organise di nationwide protest, reject di
proposal wey di IGP give.
On 31 July wey be di eve of di protest, di Lagos State Police
Command say dem discover and detonate one Improvised Explosive Device (IED)
along Mobolaji Bank Anthony Way, Ikeja wey be di capital of di state.
For Ojota wia di protest dey take place for Lagos, police
personnel dey on ground.
For Bauchi, di state police commissioner, Auwal Mohammed, tok say
di command don deploy personnel to possible flashpoints to prevent di breakdown
of law and order.
Why Nigerians dey protest?
“We dey protest because we dey hungry,” Nigerian activist Banwo Olagokun tell BBC.
Im dey part of di Take It Back Movement, one of di groups wey call for 10 days of protest from dis Thursday – even though goment don beg dem to stand down.
“We dey protest becos di inflation rate don affect us to di point wey we no fit afford di simple tins of life - food, water, clothes, medicals,” Oga Olagokun, 36, add put.
Nigeria dey experience dia worst economic crisis in a generation. Annual inflation dey at 34.19% - dia highest in almost three decades. Food prices dey rise even faster - for example, for di commercial capital, Lagos, yams na almost four times more expensive dan last year.
Pipo dey often say Nigerians dey tough and dem also say dem sabi adapt quick- quick to changing circumstances.
Nigeria President Bola Tinubu bin plead wit im kontri pipo say make dem shelve di protests but dem insist say di protest gatz go on.
State govnors, traditional ruler and oda stakeholders also lend dia voices against di protest but di organisers say di demonstration gatz go on.
Good morning!
Welcome to Pidgin live page wia we go bring you updates of End Bad Governance protest wey dey happun across Nigeria today.
Why Nigerians dey protest on August 1
'Sake of high cost, na potato my family dey chop now even though na yam we prefer'