Anambra governorship election live updates as e hapun

Dis na di live coverage of di 2025 governorship election for Anambra state, South east Nigeria

Summary

Live Coverage

Victor Ezeama and Adesola Ikulajulo

  1. History of Anambra elections since 1999

      • Author, Victor Ezeama
      • Role, BBC Pidgin

    Anambra State dey very special for election matter for Nigeria bicos na di state be di first wey start off-season election for Nigeria since di kontri return to democratic rule in 1999.

    E start wen di Supreme Court declare Peter Obi winner of di 2003 govnorship election, three years afta di Independent National Electoral Commission (Inec) bin don declare Chris Ngige of di Peoples Democratic Party (PDP) winner and dem swear am in.

    Obi also go to court and get judgement say im four-year tenure start on di day wey e take di oath of office.

    Since dat time, many oda states wia similar tin bin happen don also get election calendars wey dey different from di general election period wey Nigeria dey run.

    Willi Obiano na di fourth govnor of Anambra State. E serve from 17 March 2014 to 17 March 2022.

    Di fifth govnor of di state na Charles Soludo wey win di 2021 election. Oga Soludo dey seek re-election for 2025.

  2. Inec officials don reach many polling units

    Anambra election 2025

    Di governorship election for Anambra state do start wit Inec officials wey don reach dia polling units.

    Our tori pesin capture as di officials dey set up wetin dem go use do di election.

    Some voters don also already begin check dia names for di voters list.

    Anambra election 2025
    Anambra election 2025
    Anambra election 2025
  3. Full list of candidates for di election and dia political parties

    Na 16 candidates Inec clear to contest di election. Dem be;

    • Onyeeze Chidi Charles – Accord Party (A)
    • Nweke Ezechukwu Japhet – Action Alliance (AA)
    • Ifemeludike Chioma Grace – Africa Action Congress (AAC)
    • Nwosu Chima John – African Democratic Congress (ADC)
    • Nicholas Ukachukwu – All Progressives Congress (APC)
    • Soludo Charles Chukwuma – All Progressives Grand Alliance (APGA)
    • Otti Cyprain Echezona – Allied Peoples Movement (APM)
    • Nweke Chrispopher Chukwudubem – Action Peoples Party (APP)
    • Okeke Chika Jerry – Boot Party (BP)
    • Moghalu George Nnadubem Labour Party (LP)
    • Onyejegbu Geoffrey – New Nigeria Peoples Party (NNPP)
    • Ndidi Christy Olieh – National Rescue Movement (NRM)
    • Ezenwafor Jude – Peoples Democratic Party (PDP)
    • Chukwurah Vincent – Social Democratuc Party (SDP)
    • Chukwuma Paul Chukwuka – Young Progressives Party (YPP)
    • Ugwoji Uchenna Martin – Zenith Labour Party (ZLP)
  4. All don set for di governorship election for Anambra state

    Key candidates for di election

    Evritin don set for di guvnorship election for Anambra State, southeast Nigeria, wey go shele today.

    Di incumbent govnor of di State, Chukwuma Soludo – wey be di bifor-bifor govnor of di Central Bank of Nigeria - go face 15 oda candidates wey dey drag di office for am as e wan do im second term.

    Anambra State dey very strategic for Nigeria bicos na one of di major link states wey dey join di southeastern region of Nigeria to di oda parts of di kontri, so plenty pipo dey always chook eye about wetin dey happun dia.

  5. Ova 50,000 personnel to provide security

    Di Nigeria Police Force say dem go deploy 45,000 of dia officers and men to guarantee safety during di election period.

    "All di vigilante groups and all di oda agencies of di states no go dey allowed to play any role during dis election," according to Abayomi Shogunle who be di oga of Elections Planning, Monitoring and Evaluation unit.

    Shogunle tok dis one for one meeting of Inec and security pipo to prepare for di Anambra election.

    E say di police operation for di state go begin from di start of November to make sure say all di pipo go try to cause trouble go dey disarmed, arrested, and prosecuted.

    Also, Ahmed Audi, di Commandant General of di Nigeria Security and Civil Defence Corps (NSCDC), say dem go also send 10,250 personnel for di Anambra election.Link

  6. Una welcome

    How una dey!

    Welcome to our coverage of di governorship election wey dey happn for Anambra state.

    Na Victor and Adesola dey hail una.

    Our tori pipo full ground evriwia for Anambra state dey monitor as tins dey go.

    We go bring you all di tori as e dey happun for di election from now till dem announce di winner.