Ghana 2024 election: Ghanaians vote to elect new leaders

Live coverage of Ghana 2024 election

Summary

  • Polls officially close for Ghana election
  • One pesin die for shooting incident for northern region
  • NDC presidential candidate John Mahama don vote
  • Ruling NPP presidential candidate Mahamudu Bawumia don cast im vote
  • Interior ministry announce closure of land borders
  • Army deploy for election monitoring, to stay away from polling units
  • Ghana EC assure of credible polls

Live Coverage

Victor Ezeama and Helen Oyibo

  1. Ghana election: First time voter share voting experience

    Foto of  Bridget Asante

    Twenty-five-year-old, Bridget Asante decide to partake in di presidential elections for di first time since she become adult..

    She tok say say decide to cast her vote for her preferred candidate as Ghana citizen.

    As a first time voter, she say di experience dey smooth for her and she dey expect whoever win to build di Ghana and make di youth comfortable.

    "I wan di pesin wey win to give us di Ghana wey we want and make di youth dey okay," she tok.

  2. 'We dey expect anoda president wey go come rule dis kontri'

    Wetin we call dis Video, Concerned traders and market women for Ghana dey hope for better life

    Concerned traders and market women for Ghana dey hope for better life afta presidential election.

    Di women lament di rising cost of goods and services, high cost of living plus poor economy.

    Dem say dem get high expectation from whoever win.

    Dem hope say whoever win di election go fix di economy, better di lives of women, enable good governance and kontinu di free education of di current administration.

  3. NPP vice presidential candidate cast im vote for Kumasi

    Dr Mathew Opoku Prempeh on white shirt to cast im vote
    Wetin we call dis foto, Dr Mathew Opoku Prempeh arrive im unit to vote

    Di vice presidential candidate of di governing NPP, Dr Mathew Opoku Prempeh don cast im vote for Kumasi.

    NPP and oda political parties go battle am out for dis election wit ova 18million voters.

    Dr Mathew Opoku Prempeh on white shirt
    Wetin we call dis foto, Dr Mathew Opoku Prempeh wan cast im vote
    Vice presidential candidate of NPP on white shirt wit a woman
  4. Breaking, Ruling NPP presidential candidate Mahamudu Bawumia cast im vote

    Mahamudu Bawumia cast im vote

    Wia dis foto come from, Mahamudu Bawumia

    Di Vice president of Ghana wey also be di candidate for di New Patriotic Party (NPP) Mahamudu Bawumia, don cast im vote for di ongoing Ghana election.

    Bawumia cast im vote for di Walewale constituency of di Savannah Region for Ghana.

    Bawumia, wey currently be Ghana vice-president, na from di governing New Patriotic Party (NPP) as dia candidate wey dem choose for di forthcoming general election.

    Bawumia bin rise from being a political outsider to become Ghana second-in-command - and on 7 December e fit make history as di kontri first Muslim president.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

    Mahamudu Bawumia cast im vote

    Wia dis foto come from, Mahamudu Bawumia

    Mahamudu Bawumia cast im vote

    Wia dis foto come from, Mahamudu Bawumia

  5. Voting don dey go on for Accra

    Electoral officer dey check di voters list
    Wetin we call dis foto, An elderly man dey try accredit imsef wit di help of di electoral officer

    Voting don dey go on for Acca, di capital of Ghana wia voters don alreadi dey cast ballot.

    Na ova 18million voters wey dey expected to come out to cast dia votes for dis Ghana presidential and parliamentary election.

    Na 40,976 polling stations dey across Ghana and dem get securiti officials wey stand dey watch as di process dey go.

  6. Fotos of how Ghanaian voters show up for election

    Millions of voters for Ghana dey expected to come exercise dia voting power today for di election.

    Alreadi, plenti of dem don dey queue across stations for Accra, Tamale and Kumasi. Dem wan cast dia votes.

    We capture some moments wey voters dey cast dia votes for Ghana.

    A man in front of di voting cubicle
    Wetin we call dis foto, Dis ma reach di voting cubicle to cast im vote
    Electoral officers on blue accrediting a voter
    Wetin we call dis foto, Dis woman don join queue to do her own election accreditation
    A queue of Ghanaians
    Wetin we call dis foto, Voters don queue to begin di election process
    Voters don queue to begin di election process
    Voters don queue to begin di election process
  7. GAF dey on standby for di election

    No military personnel go dey stationed for any polling unit, di Ghana Armed Forces tok.

    Tok-tok pesin for di Armed Forces E. Aggrey-Quashie for one statement tok say dem go deploy dia personnel go designated locations in support of di Ghana police for di peaceful conduct of di elections.

    E say make citizens no fear if dem see military dey waka about for dia area.

    “Di military go only dey deployed upon request by di Ghana Police Service. Dis collaborative approach go ensure say di election go on smoothly and peacefully, while maintaining law and order,” di statement tok.

  8. Electoral Commission promise to deliver free, fair and credible election

    Wetin we call dis Video, Electoral Commission promise to deliver free, fair and credible election

    All don set for di Ghana election as di electoral commission don express readiness to conduct "orderly, credible, fair and highly professional and efficient election. "

    Di Chairman of di commission Jean Mensa for her last minute charge to officials of di electoral body ahead of di election tok say dia work no be to make anybody president or member of parliament but to ensure free and fair election.

    Madam Mensa charge di electoral officers say make dem carry out di election wit integrity and make di truth guide dem always.

  9. Ghana Interior Ministry close land borders temporarily

    Pipo dey stranded for border

    Wia dis foto come from, Sylvia Awuye

    Di Ministry of Interior for Ghana yesterday order di temporary closure of all land borders sake of di election wey dey happun today.

    According to di ministry, dis na part of measures to ensure di integrity of di elections.

    "Di temporary closure na wit immediate effect and e go end at 6:00pm on Sunday, 8 December." Di Ministry announce for one statement wey Henry Quartey sign for di Minister of Interior.

    Dem urge citizens to and from Ghana to cooperate wit state security agents wey dey enforce dis directive.

    Dis announcement don generate reaction from di main opposition party, di National Democratic Congress.

  10. Welcome to our Ghana election coverage

    Ghana pipo go enta poll today to vote a new president.

    We dey live for different parts of Ghana to bring una live reports of di election as e dey happun.

    Tanda wit us from now till wen dem go announce di winner of di election.

  11. Polls open for Ghana elections

    Polls open in Ghana election

    Polls don open for Ghana, wia ova 18 million registered voters dey elect a new President plus Members of Parliament.

    12 Presidential hopefuls including one female candidate dey on di ballot. But di contest go dey tight between di current Vice-President Mahamadu Bawumia and opposition candidate former President John Mahama.

    Ghanaians begin queue for polling units bifor polls open as dem dey eager to cast dia vote. But na di state of di economy go make a difference for dis election.

    • Ghana get one of Africa most stable democracies for a region wia military coups dey common.
    • Di election na close contest between incumbent, Vice President Mahamadu Bawumia and one former President John Mahama.
    • Di winner of di election go face ogbonge challenges in dealing wit d kontri biggest economic crisis in years.
    Polls open in Ghana election
    Wetin we call dis foto, Election officers begin set materials for election
    Polls open in Ghana election
    Polls open in Ghana election