Donald Trump make history as e win US presidential election
Donald Trump don win di US election and go make a historic return to di White House
Summary
Donald Trump don win di US election and go make a historic return to di White House
Of di seven key swing states, Trump win North Carolina, Georgia, Pennsylvania and Wisconsin, and dey ahead for Michigan, Nevada, and Arizona
Kamala Harris never concede yet or address supporters - unhappy crowds comot her watch party before di final result come in
Republicans don also take di Senate back from Democrats after dem flip some seats
World leaders don congratulate Trump
Nigeria President Bola Tinubu congratulate Donald Trump
Live Coverage
Helen Oyibo, Adebola Ajayi, Kareemot Salami, Victor Ezeama and Fiona Equere
European leaders congratulate Trump
As Europe dey wake up to di news say Donald Trump dey
likely to win di US election, dis na how
some leaders dey react:
French President Emmanuel Macron say Im dey "ready to
work togeda" wit Trump for a second time
Meanwhile, Ukraine President Volodymr Zelenksy congratulate
Trump and praise im commitment to "peace through strength" – wey im say
go "bring a just peace for Ukraine closer"
Mark Rutte, Nato secretary general, share Zelensky sentiment
and say Trump leadership dey "key" sake of " growing number of
challenges globally"
Italy Prime Minister Giorgia Meloni praise her kontri
"unshakeable alliance" wit US and add say na bond wey go "strong
more" wit Trump
Petr Fiala, di Czech prime minister, say im want "
ensure say di relations between kontris remain at di highest level ... and add
say we go kotinu to develop dem for di benefit of our citizens"
We dey yet to hear reaction from Russian President Vladimir
Putin
India Prime Minister congratulate Donald Trump, say e dey look forward to India-US relationship
Di Prime Minister of India Narendra Modi don congratulate Donald Trump for di ongoing US election.
For im post for X, Modi say e dey look forward to renew dia collabo to help di India-US partnership.
"Togeda, make we work for di bertterment of our pipo and to promote global peace, stability and prosperity."
Wia dis foto come from, X@narendramodi
About last night - Election night as e happun
Wia dis foto come from, Reuters
Donald Trump dey four electoral college votes away
from being declared di 47th president of US.
Afta a busy night - one wey no dey close like di
polls suggest – dis na some of di key moments:
Trump deliver victory speech to im supporters for
Florida, moments afta dem call di key swing state of Pennsylvania in im favour,
e vow to heal di kontri and send US into a "golden age"
CEO of X Elon Musk dey among those wey receive a
shout-out from Trump, e describe am as a "new star" of di Republican
Party, while im running mate JD Vance describe Trump win as "di greatest
political comeback ever"
For contrasting scenes, Kamala Harris supporters leave
dia official watch party for Washington DC early, images show untouched
American flags for carboard boxes
So far three swing states, Pennsylvania, North
Carolina and Georgia, dem call dem for Trump – im dey ahead for di four wey
remain: Arizona, Nevada, Wisconsin and Michigan
Minnesota and New Jersey na some of di states wey
dem don call for Harris, wey, along wit reliably blue areas, put her at 219
electoral college votes so far
Meanwhile, the Republican Party also dey set to
take control of di Senate; di Democrats fai to unseat Ted Cruz forTexas, wey be
on one dia key targets
Counting still dey go on for a handful of states,
so stick with us as we wait to hear those results and bring you all the latest.
Nigeria President Bola Tinubu congratulate Donald Trump
Wia dis foto come from, Presidency/Reuters
Nigeria President Bola Tinubu don send congratulatory message give Donald Trump as di US election dey go on.
President Tinubu say im dey look forward to how Nigeria and di US go begin strengthen di ties wey dey between dem.
“Togeda we fit collabo on economic cooperation, promote peace, and address global challenges wey dey affect our citizens,” President Tinubu.
Dis message dey come for time wey di US election dey go on and Trump dey lead for votes wey don come in.
Nigeria president say e believe say Trump get experience and go use am bring di worl "closer to peace and prosperity."
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
Trump supporters dey 'super happy' and 'feeling grateful'
Di mood wey dey outside di Palm Beach Convention Centre around 04:00 dey happy as Donald Trump supporters dey come out of im election night party.
Pickup trucks wey dey drive passdey blow dia horns and anoda man on a motorcycle dey play Trump song.
Fatima Henges, 30, dance across di street as she leave di party tonight and say she dey "happy, super happy" about di results so far.
"We no wan go home, but we gatz go work tomorrow," she say. "I tink say e dey good for everyone, na change."
Some democrats don begin analyse wetin happun
Wia dis foto come from, Reuters
For some Democratic Party circles, dem don begin analyse di
election even though dem neva officially call di results.
One Democrat political operative for DC texts to say di party
"need to flush out elitist snobs for DC for a start".
Odas tell me di same tin – while dem praise di efforts of di campaign, dem feel say di party as
a whole get 'image problem' at a time wen basic, evri day tins like di cost of
living dey most voters mind.
Dis Democrat mata remind me of di conversation I bin get wit
one Republican for one Trump rally wey
say dia candidate don completely "reimagined" di Republican party
from im kontri club voter stereotype to appealing to working class families,
while di Democrats don become di "party of Hollywood".
Dis na big generalisations, but ones Republicans publicly,
and some Democrats privately, now dey share.
UK prime minister say e dey look forward to work wit Trump
Keir Starmer na anoda next world leader to congratulate Donald Trump on wetin e call a "historic election victory".
"I look forward to work wit you for di years ahead," di UK prime minister tok.
“As di closest of allies, we stand shoulder to shoulder for defence of our shared values of freedom, democracy and enterprise.
“From growth and security to innovation and tech, I know say di UK-US special relationship go kontinue to prosper on both sides of di Atlantic for years to come.”
Nigeria Chief of Army Staff Lt Gen Taoreed Abiodun Lagbaja don die
Wetin Trump tok for im victory speech?
Donald
Trump don declare victory for US presidential election, im deliver speech to im
supporters for im watch party for Florida.
In
case you miss am, dis na wetin im tok:
Trump
thank voters: "I wan thank American pipo for di ogbonge honour of
being elected as una 47th president and una 45th president"
Im say im
don win di popular vote: Dem still dey count di votes, but Trump dey set
to win di majority of votes for dis election. "America don give us
ogbonge and powerful mandate," Im tok
JD Vance
"turn out to be a good choice": Trump praise im running mate,
wey say Trump just pulloff "di greatest political comeback for
American history" during di speech
Elon musk
na "star": A part of Trump speech im dedicate am to di tech
billionaire, Trump call am "an amazing guy"
RFK Jr go
"make America healthy again": Trump appear to suggest Robert F
Kennedy Jr - di former independent presidential candidate, wey get history
of supporting conspiracy theories about vaccines – go get role relating to
healthcare for im administration. Kennedy withdraw from di race for August
to endorse Trump
Israeli PM congratulate Trump 'on history greatest comeback'
Wia dis foto come from, Reuters
Wetin we call dis foto, Netanyahu and Trump, for photo for 2020
As Donald Trump declare victory for dis presidential election,
some world leaders don start to congratulate am.
"Congratulations on history greatest comeback! Your
historic return to White House go offer a new beginning for America and a
powerful recommitment to di great alliance between Israel and America," na
so Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu.
Im add say: "Dis na huge victory!"
And Hungarian Prime Minister Viktor Orban say sometin similar:
"Di biggest comeback in US political history! Congratulations to President
Donald Trump for im ogbonge win. A much needed victory for di World!"
UK prime minister say im dey look forward to work wit Trump
Keir Starmer congratulate Donald Trump on wetin im call
"historic election victory".
"I dey look forward to work wit you in di years
ahead," UK prime minister tok, and add say:
“As di closest of allies, we dey stand shoulder to shoulder in
defence of our shared values of freedom, democracy and enterprise.
“From growth and security to innovation and tech, I know say
UK-US special relationship go kotinu to prosper on both sides of di Atlantic
for years to come.”
French president Emmanuel Macron say: ‘’Congratulations,
President I dey ready to work togeda wit you as we bin do for four years. Wit
your conviction and my own. Wit respect and ambition. For more peace and
prosperity.’’
As a reminder: Trump don declare victory - but im neva reach di
required number of electoral college votes. Im just need four to reach 270.
Kamala Harris dey on 219.
As Donald Trump declare victory for dis presidential election,
some world leaders don start to congratulate am.
"Congratulations on history’s greatest comeback! Your
historic return to White House go offer a new beginning for America and a
powerful recommitment to di great alliance between Israel and America," na
so Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu.
Im add say: "Dis na huge victory!"
And Hungarian Prime Minister Viktor Orban say sometin similar:
"Di biggest comeback in US political history! Congratulations to President
Donald Trump for im ogbonge win. A much needed victory for di World!"
UK prime minister say im dey look forward to work wit Trump
Keir Starmer congratulate Donald Trump on wetin im call
"historic election victory".
"I dey look forward to work wit you in di years
ahead," UK prime minister tok, and add say:
“As di closest of allies, we dey stand shoulder to shoulder in
defence of our shared values of freedom, democracy and enterprise.
“From growth and security to innovation and tech, I know say
UK-US special relationship go kotinu to prosper on both sides of di Atlantic
for years to come.”
French president Emmanuel Macron say: ‘’Congratulations,
President I dey ready to work togeda wit you as we bin do for four years. Wit
your conviction and my own. Wit respect and ambition. For more peace and
prosperity.’’
As a reminder: Trump don declare victory - but im neva reach di
required number of electoral college votes. Im just need four to reach 270.
Kamala Harris dey on 219.
Trump dey on course to win popular vote as well
As tins stand, Donald Trump dey set to win di popular vote - i.e., win di most votes in total - something wey im no even do for 2016.
Im don vow retribution and revenge if im go back to di White House.
Im also vow di biggest deportation of migrants in history, more tariffs on foreign trade and promise to end di war for Ukraine and Middle East – although im never tok how im go do am.
Di list of tins im plan to do plenty. But im get im mandate
So there's a shopping list of all shopping lists there. But he has his mandate.
Donald Trump appear wit im wife and campaign pipo
Wia dis foto come from, Reuters
Donald Trump take to di stage for im campaign watch party for West Palm Beach, Florida, wia large crowd cheer am up.
Although, Trump neva win yet becos e still get four electoral college votes to clear bifor e fit dey qualified for victory.
Wen Trump appear for stage, odas wey dey wit am include im running mate JD Vance, wife Melania Trump and campaign staff.
'We go help our kontri heal' - Trump
Wia dis foto come from, Reuters
Trump say: "We go help our kontri heal."
Im promise to fix di borders, and add say him and im party make history for a reason. Clearly di Republican candidate dey use dis as im victory speech.
Trump also say dis go be di "golden age" of America.
"Dis na magnificent victory for di American pipo, wey go allow us to make America great again," im add, as in use im campaign slogan and catchphrase.
Trump declare victory, although im neva achieve di official required electoral college votes yet.
Una welcome to our second day of di coverage of di US election 2024.
Make you tanda wit us as we bring una up to date informate as e dey happun,