Mahamudu Bawumia congratulate John Mahama before Electoral Commission announce results

Di election process for Ghana continue on day two wit collation of results for presidential and parliamentary levels.

Summary

  • Mahamudu Bawumia concede defeat to John Mahama
  • Opposition NDC claim say dem dey lead
  • Voting end, collation and announcement of results start for Ghana election
  • Voters remain anxious sake of slow election process
  • Ghana presidential election 2024 result update

Live Coverage

Victor Ezeama, Komla Adom and Annette Arotiba

  1. Breaking, Bawumia congratulate Mahama

    Di moment oga Bawumia congratulate John Mahama
    Wetin we call dis foto, Di moment oga Bawumia congratulate John Mahama

    Ruling party candidate Vice President Dr Mahamudu Bawumia don concede defeat to former President John Mahama.

    Dis na even though di electoral commission neva announce result.

    Vice President Bawumia for news conference dis morning say im decision na based on provisional results collated.

    Ghana hold general elections yesterday to elect a new president and members of parliament.

  2. Mahamudu Bawumia ruling NPP candidate concede defeat to John Mahama

  3. Opposition NDC claim say dem dey lead

    Communications officer of di opposition NDC say di party get hope say dey go win three constituencies for di Ashanti region wey currently dey under challenge.

    Oga Sammy Gyamfi for one press conference say “we dey confident say afta dem solve di challenge wit dis three constituencies, we go win those seats.”

    Dis three constituencies na Mankraso, Obuasi East and Tepa.

    According to di NDC tok tok pesin, dem don retain dia 4 seats for di Ashanti region wia dem add 3 extra seats to make it 7 seats so far.

    Im tok say if “we know say afta dis three constituencies wey dey under challenge, we go win dem also, to make it 10 seats for di region wia be di strong hold of di goment NPP.”

    Di Ghana Electoral commission neve release any official result.

    Meanwhile di party don dey vex for di electoral commission as dem accuse dem of delaying di collation of results for di constituencies and di regions across di kontri

    Sammy Gyamfi
  4. Communications minister Ursula Owusu lose Ablekuma West constituency

    Communications minister

    Wia dis foto come from, Ursula Owusu-Ekuful/Facebook

    Wetin we call dis foto, Ghana Communications Ursula Owusu-Ekuful

    One ogbonge minister of state Ursula Owusu-Ekuful don lose di Ablekuma west parliamentary seat for di Greater Accra region.

    Di minister loose to di NDC candidate Reverend Kweku Addo afta im dey parliament since 2012.

    For di goment party NPP, Ursula na one of di leading members wia im serve as minister of communications for eight years.

    Result wey di EC returning officer announce na;

    • Ursula Owusu-Ekuful (NPP) - 26,575
    • Reverend Kweku Addo (NDC) - 31866

    Rejected - 351

    Total voter population - 99465

    Total valid votes - 58441

  5. Independent candidate win for NPP stronghold for Ashanti region

    Ohene Kwame Frimpong/Facebook

    Wia dis foto come from, Ohene Kwame Frimpong/Facebook

    Wetin we call dis foto, Ohene Kwame Frimpong, independent candidate

    One independent candidate wia be businessman don win di Asante Akim North seat for di Ashanti region.

    Ohene Kwame Frimpong win di vote wit ova 18,000 votes.

    For many sabi pipo, dis gap don dey shocking as many bin tink say di sitting MP Andy Appiah Kubi go retain di seat.

    Di result wey di EC returning officer announce na;

    • Andy Appiah Kubi (NPP) - 8,933
    • Ohene Kwame Frimpong (independent) - 26,926
    • Kofi Asamoah (NDC) - 2,469

    Total valid - 38,328

    Total rejected ballot - 513

    Total vote cast : 38,841

  6. Tourism minister lose for Sekondi constituency - Western Region

    Andrew Egyapa Mercer

    Wia dis foto come from, Andrew Egyapa Mercer/Facebook

    Wetin we call dis foto, NPP MP and tourism minister Andrew Egyapa Mercer

    Tourism minister Andrew Egyapa Mercer wey bifor na deputy energy minister don lose im parliamentary seat.

    Andrew na ogbonge member of di goment party di NPP, wia im lose im seat to di NDC candidate.

    Lawyer Mercer na MP for dis constituency since 2016.

    Hia na result wey di retuning officer declare;

    • Andrew Egyapa Mercer (NPP) - 11,084
    • Blay Nyameke Armah (NDC) - 14, 558

    Rejected ballot - 176

    Total valid votes - 25,642

    Total votes cast - 25,818

    Di MP-elect Blay Nyameke Armah of di NDC tok say im tank im constituents wey im tok say “dis win na win for di whole constituency and we go rebuild and reset sekondi togeda.”

  7. Electoral commission overview afta close of voting

    EC logo

    Di electoral commission confam say as at 5pm on 7 December, 95% of polling stations across di kontri don close polls.

    Oga Bannor Bio wey be director of electoral service tok say “only a few polling stations continue to vote afta 5 pm sake of dem no start early wia some places bin get some wahala.”

    Di EC also say dia early report bin show say dia biometric verification devices bin work smoothly across di ova 40,000 polling stations across di kontri.

    “Also voting don happun fast dis year as each pesin neva spend more than 3 minutes to vote. Dis be sake of how we divide some of di polling stations wia each voting center get only 750 voters, to avoid crowd and long queues,” oga Bannor Bio explain.

  8. Lights go off for at least two constituencies during collation

    As counting of ballots and collation bin dey happun late into di night, some chaos don dey happun.

    For di Ayawaso north and Madina constituencies, light bin go off wey cause some tension among di supporters of di candidates wia dey dis centres for Accra.

    Dis power outage bin affect di process for sometime bifor dem later kontinu.

    Director of electoral services for di electoral commission confam during dia press conference say dem dey fix di mata

    “Di EC bin engage di electricity company of Ghana to restore power to dis two collation centres. We get hope say dem go restore di light as soon as possible,” oga Bannor Bio tok.

  9. Chaos for some constituency polling stations

    For di Western region of di kontri, police bin arrest one pesin say im engage for double voting in di Wassa Akropong-Appiahkrom polling station.

    Dis pesin na polling station agent - police say im dey dia custody to dey assist di police for dis investigation.

    For di Okaikwei south constituency for Accra, di police arrest one pesin wey don dey hold weapon for di St Theresa school polling station

    In di Bono East region of di kontri, police don gbab one electoral commission official.

  10. Interior minister Henry Quartey lose im seat as MP for Ayawaso Central constituency

    Interior minister, NPP MP Henry Quartey

    Wia dis foto come from, Photos: Ministry of Interior/Facebook

    Wetin we call dis foto, Interior minister, NPP MP Henry Quartey

    Henry Quartey na ogbonge pesin for di goment party. Bifor di president select am as interior minister, im be di greater Accra regional minister

    Im lose di election to di NDC candidate Abdul Rauf Tubazu.

    Result wey Ghana EC Gladstone Agboada announce na;

    • Henry Quartey (NPP) - 23,345
    • Abdul Rauf Tubazu (NDC) - 29,755
    • Charles Kwame Adams (NDP) - 163

    Rejected ballot - 287

    Total votes cast - 53,550

    Afta dem declare am winner, Abdul Rauf tok say im bin dey confident since, say im go win.

    “Dis win don sweet sake of all di executives of di party don try well well wia we achieve dis result. We go work for di pipo.”

  11. VP, NPP candidate Dr Bawumia confident of victory

    Mahamudu Bawumia

    Wia dis foto come from, Mahamudu Bawumia

    Vice President and and presidential candidate of NPP Dr Mahamudu Bawumia say im dey confident of victory.

    Oga Bawumia tok dis one afta e vote for im hometown Walewale for di north east region of di kontri yesterday.

    “I dey confident of victory, Ghana pipo don experience di transformation we don bring for dia life wey I believe say dem go make di right choice to continue on di path of progress,” e tell tori pipo.

  12. Wetin opposition candidate Mahama tok afta im vote

    John Mahama

    Wia dis foto come from, John Mahama

    Opposition candidate ex-president John Mahama afta im cast vote for im home town for Bole Bamboi in di Savannah region of Ghana tok say im get hope say im party di NDC go win.

    “I dey confident say Ghana pipo go give me di opportunity to serve again, I bin trust in di democratic process wey i believe in di choice of di pipo.”

    Im tok say if tins go smooth as dey suppose go, im party go win.

    Di ex-president and opposition candidate also bin visit im papa im grave to pray bifor im cast im vote.

  13. Police arrest four suspects for shooting incident

    Shooting suspects

    Wia dis foto come from, Ghana police

    Di Ghana police say dem arrest four pipo ova one shooting incident for di Awuku Senya East constituency for di central region wey lead to di death of one pesin wit anoda one injured.

    Di suspects dey dia custody while investigation kontinu.

    Di pesin wey don hurt bin dey receive treatment for hospital wia dem carry di body of pesin wey die to morgue for autopsy

  14. Highlights of wetin don happun so far

    Election open for Ghana yesterday wia many voters come out as early as 5am to join di line to vote.

    As voting start, many oda tins begin happun.

    Dis na some highlights of our tori yesterday;

    • Polls officially close for Ghana election
    • One pesin die for shooting incident for northern region
    • NDC presidential candidate John Mahama don vote
    • Ruling NPP presidential candidate Mahamudu Bawumia don cast im vote
    • Interior ministry announce closure of land borders
    • Army deploy for election monitoring, to stay away from polling units
    • Ghana EC assure of credible polls
  15. Una welcome to our Day 2 coverage of Ghana elections

    Dis na di second day of di 2024 elections for Ghana.

    Di election wey start yesterday go kontinu today wit collation and announcement of results.

    Make una dey wit us to till dem announce di final result.