27"
Gana Gueye and Diatta try to connect to create chance inside di Egypt area but di Pharaohs clear dia lines. Di lose ball no find Nicolas Jackson. wey bin dey lurk for di box
Morocco defeat Nigeria 4-2 on penalties to reach Afcon 2025 final.
Komla Adom, Tamara Ebiwei, Helen Oyibo
27"
Gana Gueye and Diatta try to connect to create chance inside di Egypt area but di Pharaohs clear dia lines. Di lose ball no find Nicolas Jackson. wey bin dey lurk for di box
25"
Senegal dey try to create sometin thru Mane, Ndiaye and odas but Egypt don block di ball bifor e go even reach dia area
23"
Egypt keeper El Shenaawy comot to catch one ball inside di area as Senegal dey try to create sometin.
21" SUBS
Di Senegal captain no fit continue dis game, ge sit for ground again wey di medical team carry stretcher enta di park to carry am. But di Al Hilal defender waka comot di park. Mamadou Sarr bin replace am
20"
Senegal take di throw in afta Koulibaly receive treatment. Senegal coach Thiaw ask one player to begin to warm up if Koulibaly no fit continue.
19"
Senegal dey pepper di Egypt area but so far dem neva penetrate yet. Koulibaly wey get yellow card now now, dey for ground. He hurt.
18"
CHAAAANCE!
Nicolas Jackson get one chance in front of di Egypt box wey he smash di ball wide.
17"
Omar Marmoush wey win di freekick don strike am but di ball spoil. Waste.
16"
YELLOW CARD
Kalidou Koulibaly don foul Omar Marmoush. He go miss di final if Senegal qualify for final, e go be di second time he go miss final afta he miss di 2021 final sake of suspension.
14"
Senegal get throw ball for di left side of di Egypt area but e neva be dangerous, dem clear dia lines
Salah try to beat his marker but dem block am well well, he fall for ground but e neva be foul
Fans dey chant and sing for di stands well well, so far dem neva get any chance to celebrate. Di medical team don treat Diouf bifor di game contiue wit an Egypt throw ball.
Egypt now dey grow into di game now wit some good passes wey dem win corner. Diouf don dey for ground as di cross don hit im groin area.
From di freekick, Senegal don win corner. Diouf take di corner for di left hand side of di Egypt goal, but di ball neva trouble di keeper.
YELLOW CARD!
Dem bin foul Nicolas Jackson close to di Egypt area. Referee don give Abdelmaguid don chop yellow. He go miss di final if Egypt qualify
Emam Ashour fall for ground, he dey ask for freekick against Idrissa Gana Guaye but ref say e neva be foul
Ref don catch Sadio Mane say im dey offside as dem fly one ball ova di top towards di Egypt area,.
Mane, Diouf dey hold on to ossession amomg diaserf for di middle of di park bifor dem try to launch forward.
Throw ball for Egypt for di center of di park; di ball don fall to Senegal now wey dem dey try to attack di Pharaohs.
Egypt already begin to pass di ball around quick quick afta Senegal pass di ball; but Senegal stop any danger