Relive day two of end bad governance protests across Nigeria

Summary

  • Kano state government partially relax curfew to allow for prayers
  • Day two of di protests dey on across states of di federation
  • Di protests na against wetin dem describe as hunger and bad governance
  • For Abuja, Nyesom Wike wey be di Minister of di Federal Capital Territory say make demonstrators limit dia activities to di Moshood Abiola Stadium
  • Lagos, Rivers, Oyo, and some oda places dey peaceful for day two of di protest

Live Coverage

Tunde Ososanya, Annette Arotiba and Adebola Ajayi

  1. Limit your protest to Moshood Abiola Stadium - Wike

    FCT Minister, Nyesom Wike

    Wia dis foto come from, NYESOM WIKE

    "Limit your activities to di Moshood Abiola Stadium in line wit di order of di court," na so FCT Minister Nyesom Wike tell protesters wey turn out for di end bad governance for di kontri capital on Thursday, 1 August.

    E say some protesters bin try to scata Eagle square for Abuja, but security agencies stop dem, e tell protesters say make dem no carry dia demonstration pass di confined area.

    “Available intelligence show say some protesters dey plan to cause destruction of properties wey fit lead to di loss of lives of di city and security agencies no go allow am,” im tok

    Di FCT minister also allege say na one Senator dey sponsor di protesters against di goment. Wike add say security agencies go soon invite di Senator for questioning.

    “We get intelligence say na one senator dey provide food to di protesters. Dat na sponsorship... for a Senator to provide food for protesters.

    “Di security agencies go invite di senator and find out how you go dey sponsor dis kain tin against di goment of di day,” Wike tok.

    Oga Wike give dis informate as e dey follow tori pipo tok for Abuja on Thursday.

    E say di goment no dey stop protest, dem only dey beg pipo to give gomet some time to address di challenges di kontri dey face.

  2. States for northern Nigeria impose curfew

    Looting happun for Kano
    Wetin we call dis foto, Shops bin suffer looting by hoodlums for Kano

    Some states across Nigeria don impose curfew afta suspected thugs hijack di nationwide protest against di cost of living wey start on 1 August.

    Demonstrators for all major cities enta streets, begin chant slogans like: “We dey hungry, end bad governance", among odas.

    Di protest wey bin start peacefully bin turn violent for some northern states as suspected hoodlums hijack am and use di opportunity for widespread looting and destruction of property.

    States like Kano, Yobe, Nasarawa, Katsina and Borno compulsory curfew for some of di volatile local goment areas for di states.

    Di curfew no be for di whole day, some na for 24 hours only while some odas na from morning to evening - dusk to dawn.

    Di curfew don effectively bar protests from continuing for dis states and all residents dey expected to stay for house.

  3. Some fotos of EndBadGovernanceinNigeria protest from Port Harcourt

    EndBadGovernanceinNigeria protest

    Di protesters wey gada for Port Harcourt Pleasure Park don move to Fedral Secretariat complex.

    Dis na some of di fotos from Port Harcourt protest.

    EndBadGovernanceinNigeria protest
    EndBadGovernanceinNigeria protest
    EndBadGovernanceinNigeria protest
    EndBadGovernanceinNigeria
    EndBadGovernanceinNigeria
  4. Protest for southwest Nigeria bin dey peaceful

      • Author, Adesola Ikulajolu
      • Role, BBC News Pidgin
    One of di protesters for Lagos

    Di day one of di nationwide #EndBadGovernance protest bin start wit gbege for some parts of Nigeria.

    For di northern part of di kontri, di protesters bin storm di streets wit force while security agencies also show dia own force wen tins begin dey go bad.

    For Southwest, di situation bin dey calm wit police and oda security agencies monitoring di situations around di states.

    All eyes bin dey ontop Lagos state wey be di home state of President Bola Tinubu and sake of say na wia e be former govnor.

    Early morning Thursday 1 August 2024, di protesters for Lagos bin show face wit massive crowd wey trek from Ikeja reach Ojota area of di state.

    Di men of di Nigeria Police guard di protesters as dem waka peacefully.

    Even di Lagos Commissioner of Police bin come to address di protesters say make di protest no lead to violence and dem go arrest anybody wey wan scatter di peaceful march.

    Around 4pm, protesters begin dey comot di venue of di protest for Ojota as organizers advice say make dem dey go house and resume di next day.

    Meanwhile, tori comot say small gbege happun for Lekki Toll gate wia some protesters chop teargas from di police dem.

    For Ibadan, Oyo state, di protest also dey peaceful as record of casualties or looting of item no dey for any part of di state.

    Di protesters march peacefully for di state capital and di security also dey wit dem.

    Oda southwest states like Ekiti and Ondo no too get plenti crowd as pipo prefer to dey dia house.

    Di streets dey empty wit shops and markets closed.

    Unlike di northern part of di kontri, di protest bin dey peaceful for di first day and casualties no dey for di southwest.

    Make we dey see how day two go be.

  5. Apapa port area of Lagos State dey calm

    EndBadGovernance protest

    We begin our waka dis morning from Apapa area of Lagos State wia one of di seaports dey and we confam say situation for dat area dey calm.

    Dis na di day two of di #EndBadGovernanceinNigeria protest and our first observation confam say business don dey return back and pipo don dey open dia shops.

    Di Apapa area wey dey always jam pack wit traffic and heavy trailers dey free for dis morning. But no be say business activities for di port bin stop.

  6. States wey don impose curfew for di middle of protests in Nigeria and why

  7. Recap of day one of di EndBadGovernance protest

    EndBadGovernance

    Nigerians for different states of di federation including Lagos, Abuja, Rivers, Kano, Oyo, amongst odas enta streets to protest against hunger and wetin dem describe as bad governance.

    While di protest bin dey peaceful for some areas, e bin turn violent for states like Kano and Jigawa wia pipo lost dia lives.

    Suspected hoodlums for Kano also use di opportunity to loot shops and offices.

    States like Kano, Yobe, Jigawa, and Borno declare 24 hours curfew sake of different events wey happun for dose state.

    For Kano and Jigawa, na sake of say di protest bin turn violent, but di goment of Borno State declare curfew sake of di bombing by a Boko Haram suicide bomber for one rural community for di Konduga area of di state.

    Meanwhile, for Lagos, small gbege bin happun between di police and protesters for Ojota.

    Di police bin wan use force enta di protesters but dem no gree as dem stand say dia march don dey peaceful since.

    Some pipo begin dey throw water to di police but di officers no do anytin back.

    Afta small tok, di police bin begin move back in group.

    But for di south east of Nigeria, di home of di Igbo pipo, BBC Pidgin see say streets bin dey empty as pipo for di five states wey dey dis region, dey dia house dey either observe sit-at-home, or no just send di protest.

    From Enugu, Imo, Abia, Anambra reach Ebonyi, di tori na di same. All di streets dey empty like say pipo don run comot from di state.

    Different kains of reasons dey wey fit to explain di position of di south east not to protest. But one stand out pass any oda.

    Since Nigerians don dey threaten to do hunger protest for some months now, Igbo groups don dey tok say dem no wan follow protest, as dem believe say dia waka and di waka of oda parts of di kontri no be di same.

    Ohanaeze Ndigbo bin don dey announce say Igbo pipo no want any protest, instead wetin dem want na make goment release leader of di proscribed Indigenous Pipo of Biafra (IPOB), Nnamdi Kanu, create more states for di eastern region, create jobs for youths and allow Igbos hold leadership positions.

  8. Good morning!

    Welcome to day two of our live coverage of di protest wey dey happun across Nigeria.

    On Thursday 1 August 2024, many Nigerians enta street to call for an end to bad governance.

    You fit relive how e happun yesterday for here.