Osimhen and Adams goals comot Algeria for Afcon 2025 as Nigeria go face Morocco

Nigeria go meet Morocco for di semi-final of Afcon 2025 afta dem beat Algeria for di quarter-final.

Summary

  • Nigeria go meet Morocco for di semi-final of Afcon 2025 afta dem beat Algeria for di quarter-final
  • Nigeria dominate di match from start to finish, but Algeria no still make di game easy for di Super Eagles
  • First half end for goalless draw afta Nigeria and Algeria try dia luck but goal no come
  • Victor Osimhen score Nigeria first goal immediately second half start for di 47th minute
  • Adams Akor score ten minutes later wit Victor Osimhen assist for di 57th minute
  • As e stand now, Algeria and Nigeria don meet for 23 times, including both competitive and friendly matches
  • Algeria win 10 times, while Nigeria also win 10 times. Three games bin end for draw

Live Coverage

Tunde Ososanya x Tamara Ebiwei

  1. 64’ Algeria player carry ball dey run go Nigeria goal area but Nigeria defenders clear di ball.

  2. YELLOW CARD, Algeria don collect dia third yellow card

    Nouri don collect card for Algeria

  3. SUBSTITUTION, Algeria dey change three players at once

    Riyadh Mahrez don comot Moussa don enta.

    Zerrouki wey bin get yellow card also comot for Bounedja and Maza comot for Boulbina

  4. 59’ Calvin Bassey of Nigeria bin get small injury but e don stand up.

  5. GOAL, Nigeria 2-0 Algeria

    56’ Akor don score Nigeria second goal afta e collect pass from Victor Osimhen.

  6. GOAL, Nigeria 1-0 Algeria

    47’ Victor Osimhen score for Nigeria wit him heads head so ball straight inside net

  7. HALF-TIME

    45+3 Referee blow whistle for Half-time.

    Nigeria 0-0 Algeria

  8. 45+1' Osayi of Nigeria dey make beta run into di Algerian defence but Algeria player bring bam down.

  9. 45' Referee add three minutes.

  10. 45' Algeria get Throw-in, Nouri play am but notin comeout.

  11. 44' Throw-in for Nigeria, Onyeka dey play am but Nigeria defenders clear di threat.

  12. 39' Nigeria get more ball possession pass Algeria, So far Nigeria dey press Algeria neck but goal neva come.

  13. 36' Chance!!! Akor of Nigeria get beta chance e fire di ball but e go a little over di bar!!!!!

  14. 34' Match don resume afta di goalkeeper stand up.

  15. 32' Algeria goalkeeper dey for gorund dey collect treatment.

  16. 29' Nigeria play ball wey bin l;ook like say e cross di goal line but referee say NO GOAL!!!!

  17. YELLOW CARD

    28' Amoura of Algeria don collect di second yellow card afta e foul Nigeria player.

  18. 27' Algeria enta Nigeria goal area but Nigeria goalkeeper, Nwabali follow di ball witout stress.

  19. 25' Nigeria dey worry Algeria defenders as di combination of Lookman and Osimhen just dey miss beta chances.

  20. 23' Nigeria forward Ademola Lookman fire beta shot but Algeria goalkeeper catch di ball.